image
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS)

ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS)

By jclash in 9 May 2015 | 16:27
share
jclash jclash

jclash jclash

Student
Faithful User
Forums Best User
Forum Loyal User
Posts: 104
Member since: 19 Aug 2014
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS)
EPISODE 1

THIS WORK IS WRITTEN BY 'OSUSU TALKS' AND EVERY THING WAS A FAVBRICATION AND MIND PLATY OF THE WRITERm
PLEASE, IF IN ANY WAY YOU WANT TO COPY
THIS WORK OR ANY PART OF IT, KINDLY
CONTACT THE WRITER.
WRITER'S CONTACT: 08147415969;
[email protected]
THANK YOU FOR COMPLYING...
ENJOY THE STORY...

This story is written in pidgin English

Mama Chika abeg answer me before hungry subsidize my belle for here, Big T na wetin you wan chop, na small food I wan eat, oyibo dey call am appetizer, give me one plate of semovita with vegetable soup joined by pomo wey soak stew with two strong meat and fish, make one bottle of origin follow am based on step down parol with cold pure water. "Big T this ur order no be here oo say na you wan break the fasting wey Jesus do for bible, na the food be this" Mama Chika dey yarn. Mama Chika dis your food sweet ooo, hmmm you suppose to dey cook for oga presido abeg show face, see dat fine anty wey dey dat conner no collect money from her I go pay am oo, "I don hear oo" Mama Chika yarn back. Na em I dey press phone as I chop finish dey use style wait make the anty stroll go outside so I fit relate wit am, mama chika con collect your money oo.
"Bross I really appreciate you paying for my meal, am grateful" fine anty dey yarn. Oh baby dat one na small tin oo, hope say you enjoy the food. "Yes I did" fine anty dey yarn. My name na Timothy but my people dey hala me BIg T. Ok am Fumnanya by name. No vex oo I go like see dis ur fine face again oh abi yu dey stay we area. "Not at all I came to see someone, where I reside is not far from here" Fumnanya dey yarn. Ok na say you fit sample me your control number so I go hala you anytime. "Well I don't give my contact to strangers but here it is 07064*****" Fumnanya dey yarn. Ok na me just beep you now, I go call you later for night and make you flex well oo.
Na so tym waka pass like rat wey enter hole, I wan go watch Chelsea match against Manchester United for we arena wey dey my area.
Make I yarn you who I even be self, me na Big T as the name sound na so I be, I dey work for one printing press. I dey lodge for one room wey make brain oo, I never get motor but I dey play nairabet and baba ijebu so I fit hammer over night and ee get two things wey I no too like and na woman and food. As I put leg inside the arena na so people dey hail me oo like say na me won play the match, I be chelsea fan de argument won cos fight as yoruba people dey do wetin dem sabi pass which na to shout, my body don drip water tire because of the spit wey dem dey rain for there. At last I no fit happy wen chelsea win 1:0, that Diego Coasta na confirm striker and the assist wey Hazard do go join high through out the season.
As I dey enter my room na em my dey phone con dey ring, na who con be dis one again. Chia na my yoruba love be dis oo Seyi, she never repent from flashing. OmO yoruba hw you dey naw, you just sideline me oo. "Oko mi ma bi nu *my husband no vex*" Seyi dey yarn. So wetin dey for me now, when I go see you again. "Olowo ori mi ma wa si odo re lola ti month ba ti de eko *my husband I go come your place wen I enter lagos tomorrow*" Seyi dey yarn.
Na so we talk finish NEPA con sample us light wen I go bath, I dey play 2 Kings album wey Phyno and Olamide sing. Por! Por! Por! Na who be dat wey won break my door oo. Big T na me Silas, landlord say make I call you oo. I don hear make I wear cloth. Dis fine anty self I never call am. Hello how you dey. "Am fine" Fumnanya dey yarn... We relate well for phone de babe don dey put head down for me. Por! Por! Por! Oga landlord na me be dis oo. "Am coming" na woman voice I hear, oga landlord don dey carry over nite abi. Hmmmmmmm my body freeze wen I see who open the door.
DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 2



[hr]


[color=red]CHECK BELLOW FOR AVAILABLE EPISODES[/color]


Episode 2&3


Episode 4


Episode 5


Episode 6


Episode 7


Episode 8


Episode 9


Episode 10


Episode 11


Episode 12


FINAL EPISODE








9 May 2015 | 16:27
0 Likes
 
 
correct... I dey feel you die. Why I wan touch the dial? I dey mad? Abeg come sample me the next episode. Ehen, where that class rep dey? khola46. Report here shaperly. come invite the whole house because e don dey red for here.
9 May 2015 | 18:03
0 Likes
correct... I dey feel you die. Why I wan touch the dial? I dey mad? Abeg come sample me the next episode. Ehen, where that class rep dey? @khola46. Report here shaperly. come invite the whole house because e don dey red for here.
9 May 2015 | 18:04
0 Likes
Ok na,as e dey hot no let am cold,but guy u 4 complete dat babe number na,lolz
9 May 2015 | 18:42
0 Likes
Oga oo
10 May 2015 | 07:14
0 Likes
Abeg make una no vex the next episode na for morning oo, I done almost write am finish. So to say as ee dey hot, I dey feel una parol.
10 May 2015 | 07:25
0 Likes
As d first lady here,am sittin on d queen's sit....nice stowie..
10 May 2015 | 10:33
0 Likes
On behalf our first lady *OLAMI* I stone you the next episode, abeg enjoy am
10 May 2015 | 13:19
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 2 Hmmmmmmm my body freeze wen I see who open the door. I just stand still like dat horse wey dey front of union bank, na Fumnanya oo, see as she just dey shine like 100 watt bulb. My eyes scan am from head reach ground as if na virus scan no difference with her and coke bottle. Next tin wey I feel na hand wey touch me "Big T good evening and please come inside" Fumnanya dey yarn. I step inside I no even sight oga landlord for the palour. "He is coming he went to take his bath" Fumnanya dey yarn. So na who oga landlord be to you. "Well he is my uncle, I came to spend the semester break in his place" Fumnanya dey yarn. Na which school you dey. "Am a student of Osusu Private University, studying Astronomy, currently in my third year" Fumnanya dey yarn. "Big T ba wo ni, ma bi nu pe mo da e duru *how you dey no vex say I make you dey wait*. Dat room wey you book for before done dey vacant oo, if you done ready I go discount am for you" baba landlord dey yarn. I don hear baba landlord if I don ready I go come see you, good night oo. See this man, na dis useless tin ee call me for or na bad thing say I pack go my own house for Banana island. As I dey waka go my room Na eem I hear 'Big T' as I be dey expect before na fine anty dey call me. Me an Fumnanya con sit down for stair case, relate well oo until mosquito carry gallon dey hala fresh blood na so we path way. Morning no dey tey reach oo, today wey be saturday I no get tins to do na eem I call my yoruba love 'Seyi' ask her how she dey and tell am were I drop key in case she no meet me for house. Na tym to do wetin I sabi do well oo for were we people dey read newspaper for morning. See argument wey dey drop like misseles wey dem target. This Mr. Damian na football fanatic oo, ee know inside out even the match wey no concern am. Based on Chelsea win na eem men con dey rant, boil, talk tins wey fit happen n tins wey no fit. This hot afternoon better no gree come, na eem I carry phone take ring Andrew aka Irumole, Irumole na my personal padi wey sabi d way, de only student wey carry first class Accounting and Finance for him set join Masters in Womanology and no dey carry last for any matter wey carry the #BIG_T. Guy how far na, you no be confirm again oo. "Abeg Big T no vex oo I get pile of work wey nail me down for office" Andrew dey yarn. Ok I don hear, na were you dey self. "I dey for Mama Gbenga Store with that chick wey I yarn you about last time" Andrew dey yarn. No let the babe escape because I dey come there now. ...Irumole! Irumole! Irumole! How far na. Big T I loyal oh, fine girl I greet you oh. Good evening I'm Bellastone by name. Na beta tin say I know you, my guy na confirm oo I trust am reach ground and abeg make you no take am play. "Sure I won't" Bellastone dey yarn. Na so I stone words enter Irumole head, guy this your girl dey bring smoke oo na dis type of girl dey make everybody hail you for road, na beta eye you get. "You know the matter now" Andrew dey yarn. Gbenga abeg sample me two alomo bitters and one bottle water make I drink. Me con dey yarn Irumole tins wit him babe na so matter con enter Fumnanya based on who Irumole be, he give me better tips take catch the girl. As the talk dey sweet, my phone con bleep twice, chia this wicked flash wey no fit show for MTN call history, as I check am na my yoruba love. I con call her back she tell me say she dey my place already say make I waka dey come fast. Me just wan put the last particles wey setle down for my alomo bitter bottle wen I hear POO! POO! POO! Na gun shot be dat oo next thing wey I see blood don full my body.... DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 3
10 May 2015 | 13:21
0 Likes
Haa nawa oo am with you
10 May 2015 | 13:32
0 Likes
Dis one na gobe ooo,dey yarn us go we dey here gidigba
10 May 2015 | 14:05
0 Likes
Poo poo poo nah so @jessylove shot @khola46 tooo
10 May 2015 | 15:24
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 3 ...see blood don full my body and I con dey wonder why I no feel any pain, na so person fall down for my side. See big time falling hand, dis men no know say my cloth done stain. Dem no need to tell blind man say market dey catch fire, na so I push the big table take cover the same minute wey I hear the gun shot,, as I con use eyes take survey the people wey dey spray bullet. Na just three guys wey were mask as one waka near us shout say make we submit our property one after the other. Na eem Irumole con won stand up, I just tell am make ee cool down watch film wey won happen. Next tin I just say my last prayer for planet earth and I con carry two star empty bottle con still mark those strong men positions, con wear the hand glove wey I dey use for work wey dey my pocket. I waka small small reach were one dey just jump use the two bottle take clap am for head before he sample me him gun he don reach ground already, before the second one face me I done stone am the two broken bottle wey dey my hand one bottle catch am for chest while the second one meet am for lap na so ee carry ground sit down dey shout like goat wey dem chook knife for neck. Na so I pick the first guy gun, I con dive enter gutter, the last guy just dey wonder wen Jet Lee or say na Jackie Chan start to dey ack Nollywood, he just stand numb dey spray bullet for the gutter were I dey like small pikin wey dem dash new toy gun. Me done already crawl follow the gutter path take find the safest root because the last guy done dey reach were I dey. As I wan come out of the gutter na so the last guy point the gun for my neck, I nearly piss for body but dat one no move me because Irumole self dey point the guy gun for neck. Na so my advantage con advance go stage two like say na Contra I dey play, me self con come face am with the guy as police con surround us. Big T! Big T!! Big T!!! Turn music for my ear like say GLO pay Psquare make them release song wey carry Big T as for advert for them. The people they hail my name after we settle matter with the police finish. Na him me self turn Robin Hood for the area my talk dey everywhere. .... As Irumole drop me for front of my compound with one of him ride Accord 'Deadly Virus 2015 model '. Me greet am bye bye sake on say him bab e dey with am he no con branch enter my place. Any which way na way, as I cheek my phone missed call be like 2go credit for my phone Seyi don give 27 missed calls, Fumnanya too miss self, she even send me text say I no try at all say I no fit to call am since morning join some other irrelevant calls. My body dey smell like deady body wey dem no embalm because that gutter wen I dive enter be like succer way pit. Me dey step leg for compound like army wey return back from war, na so all the certified amebo con ask "kilo she le" *na wetin happen*. Me just dey story dem better lie, wey dey sweet them for ear na. Next tin wey I feel na person wey squeeze my ear "o mo pe wa ko ko de le no" *you no know say you suppose reach house first* Seyi dey yarn. She no even mind the wey I dey smell like aboki perfume wey sour, she hug me tight me no even care na so I hold am join body too. I con carry her go my room. As I enter my room every where change, ee just be like say dem pimp my room, no dirty all my cloth them done already iron am, no dirty at all, well ee no concern me but the one wey move me na the aroma wey dey erupt my nose. My yoruba love say you carry party food come put for my room. "Ra ra oo moti se oje ka le fun ee but wa ko ko lo we ke to ma jeun*not at all I done cook food wait for you but you go bath first before you eat*" Seyi dey yarn. Ok I done hear oya sereve the food down make I go bath. As I dey enter my room see wetin dey table, ee be like this my yoruba love they skype me for where she be dey, na the perfect combination be this wey I go enjoy. Amala with Ewedu and cat fish with my drink Origin two bottle and maltina na so I sit down, kiss her first, con tell her say she be better love and con tell am those sweet words wey dey make her ear ring. Me won start to dey chop na so I hear Por! Por! Por! Na who con be dis person wey no fit allow me chop first as I open the door I wan .... DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 4
11 May 2015 | 10:08
0 Likes
You wan run?
11 May 2015 | 11:09
0 Likes
Lol.... Ride on
11 May 2015 | 11:25
0 Likes
Mehn viz story ez kul jex enjoyinq every bit*nah pizzaro dey yarn*.lol.........next plzzzz
11 May 2015 | 11:59
0 Likes
As Ĩ waka reach here Ĩ no knw sef åβȋ na d aroma of d food wey seyi prepared
11 May 2015 | 12:47
0 Likes
Make e dey flow as e dey hot abeg,na charlywizzy dey yarn....
11 May 2015 | 14:20
0 Likes
Na waa o dis story get as e be I no con dey undastand sum place slf
11 May 2015 | 17:07
0 Likes
yep na police wan bundle go oo LOLZ
11 May 2015 | 17:44
0 Likes
Na reporters dey knock.....lol
11 May 2015 | 18:25
0 Likes
Abeg when this story start?? Khola deh yarn..... I.N.T.E.R.E.S.T.I.N.G
11 May 2015 | 18:34
0 Likes
Dis ur story follow sha bt me go lik say make u arrange som kind place lik 'fumilayo dey yarn, irumole dey yarn'. my guy, 4 my eye d thing no legit lik dat. Abeg make una no vex bt na my mind I jst talk so
11 May 2015 | 20:06
0 Likes
Abeg na pigin una go use take comment ooo. Make una no fear, no be run...... Big T dey na paparazzi tins on point. The combination of food fill kill person oo all this yoruba gals @Escaysegzy. Abeg make yu no vex, for fit highlight the place wey yu no uderstand @Lawman. I go work on dat prt na my 1st story be dis @Delight. Una head dey der update dey come soon
11 May 2015 | 20:27
0 Likes
I don show, make i see who de here first @tenniebenson U de here Kuwa?
11 May 2015 | 23:00
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 4 ...open the door I wan vex die wen na dis my neigbour dey disturb my peace like epan fly, wetin happen Silas. "Big T no vex oo abeg boorow me that '2 Kings albulm' so I fit play am" Silas dey yarn. Ok I done here but take this 500 take go buy your own for White Store. "Big T you do well oo, God go bless you. My love na one of my padi be dat oo, so make we chop. I almost chew my finger join as I eat finish, the food sweet like wetin dem use Aginomoto join Vedan maggi cook. Na eem I remember say I never call Fumnanya today, I con give my yoruba love exccuse go call the babe. As me and Fumnanya talk for phone for like 10 minutes, she be dey para for me but I don cool her down, wen she say she go like com my place wic I know say ee go spoil package, I just tell her say I dey run some tins for my room wey concern my work and we go meet tomorow. I use style buy chocholate wey my yoruba love like well, me just open the door, I con see wetin fit cause earthquake for man head, my yoruba love just were only p*nt and bra, dis girl I dey sure say na valentine day her parent agree to do am, because she dey beautiful and dat her behind fit make Timaya feature Beyonce for the remix of 'UKU'. Next thing she waka come were I dey con hug me, use one hand take lock the door, my mind just dey play blues because ee don tey wen I bang last. "Baby it seems your avoiding me since I came to your ..."Seyi dey yarn. I no even let her talk finish as I kiss her soft lips wey be like bread wey don soak water, the kiss just dey cent for the full room wen I hijack her go bed. The wey she dey smile be like person wey win lottery. I pull her bra wey dey hide her br*ast, chia! See as the thing stand like defender wey won block free kick. I start to dey use tongue dey ticke n cirle her n*pple and my other hand dey press the second br*ast, con leak her ear enter her neck, wen my hand don already dey untop her p*nt, dey rub her p*ssy. As I wan pull her p*nt comot she con say she won suck my d*ck aka 'spatarcus kill dem all', her mouth rap my d*ck, my head ring as if na china phone. Time don reach to act part two, na so I part her leg con use my tongue greet her p*ssy, she don dey scatter my hair as if something loss there, she con dey scream oo, na eem I con slot my d*ck small small inside hey honey pot. I rock am well, do differnt style until I pour put for her body. My yoruba girl just chin gum my body for bed and still dey use my bear bear dey play. My phone con dey ring, na Obehi dey call me, she be church member and my very good friend. Hello oh baby, how you dey na. "Good evening Brother Timothy am doing great" Obehi dey yarn. So na wetin dey for me. "Noting really, just called to check on you and peharps you weren't present for this thursday service" Obehi dey yarn. Abeg no mind me joor, na work cos am but I go show face for church tomorrow. "Ok, tomorrow is our youth sunday and have a lovely night" Obehi dey yarn. You do well, sleep well oo. Sleep na one kind thing wey fit make person late go church. Morning tins oo, church mode activated, as my yoruba love dey tidy house, me go buy wetin person go chop. ...The service na helele, dat Pastor Deborah dey preach wela but the topic na the type wey won make me close my yoruba love ear, na premarital sex she dey talk about. Well the day done dey fly as usual, flexing must dey as my yoruba love dey commot today. Na so we ball in enter 'Olori 19' Bush Bar Lounge, we drink, swim and con round everything up with better s*x for the room wey we lodge. As I wan dey excort her dey go park, I con use ATM take vommit 10K for my babe as transport, she just reject am say make I no worry, say money full her hand. My mind no sweet but no be her first time she dey do me this thing. Na so we do our goodbye loving kiss for park like say na hollywood film we dey shoot, all eyes on me as I con still dey watch as her bus take leave park. My wallet swell up and I no get wetin I won go do for house, na so I call Ufusky ma real computer geek, ee talk say he dey one bar like dat make I con hook up there. Ee no too tey wey my yoruba love call me say she done reach her place, we still talk well for phone, join the happiness say she no flash me this time. After many bottles of beer with one point and kill goat, my eyes done red, the state wey I dey I don high pass Kilimanjaro. I hail my people for table say I done dey go house. Me enter my lonely street, no human being noise at all na just crickets and rats sound I dey hear. "Ogbeni wa si ibe bi *guy man come this place*" areaboys voice. My body no even respond becasue I think say na Olamide song I dey hear 'Voice of the Steet'. Next thing na just two slap update my status, all the drink wen I done dey drink since clear from my eyes. Na four yoruba guys wey carry igbo dey smoke, dey my front. Na so I remeber the money wey dey my wallet and I need to discharge. I push one of the guys take clear road as I dey run like Usain Bolt, my leg dey touch my head wen I notice say dem no dey pursue me again. As I dey happy na so I go match dog wey dey sleep, see me see gobe, the battalion of dogs wey con dey chase me, fit pursue those missing girls come out for Sambisa forest. Na my run con enter jar two as if na 'Tunde on the Run' wey be one story wey I read for secodary school, the guy run oo but for this place na me run pass am. As I won divert enter one safe place na so I go slip my leg, con fall knack NEPA pole. DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 5
12 May 2015 | 01:20
0 Likes
Hahahahahaha......... Biq T ur problemz don dey qada mind ooo.........u sure say ur wallet neva fall 4 qround as u dy run ??? Ah dey enjoy viz story die,,,,,next plzzzzzz
12 May 2015 | 05:55
0 Likes
hope ur purse has nt fell durin d run??
12 May 2015 | 09:59
0 Likes
I dey watch film....
12 May 2015 | 12:01
0 Likes
Guy make u dey yarn dey go,no yawa!....even if u lie ontop,all join....
12 May 2015 | 18:30
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 5 As I open one eyes take survey were I dey, I con notice say na hospital I dey but any way I thank God say I survive yesterday or else nobody go fit talk the story of Big T as ee take happen. The ward wey I dey, plenty face wey I recognize dey dere like few of my compound people, Irumole and the won wey surprise me na Fumnanya. Later some of them discharge wey I don manage stand up. Na eem Irumole update me wetin happen, say dem rush me come the hospital early in the morning, say na now I just dey wake up. Fumnanya just sit down near me after she go call doctor con do check up for me. "Well young man you are deemed free to be discharged, due to you were unconscious and also sustained little bruise on your leg, and this are your prescribed drugs for you" Doctor Chinwe dey yarn. Na so Irumole con pay the bill for the hospital and still drive me and Fumnanya go my place. Na so for motor I just drop all the things wey happen to me to them. I con call my yoruba love so I fit explain everything wey happen to me for phone, she no too para for me. When I reach compound, the sorry wey dem dey rain for my body pass the won wey them tell Brazilian players after Germany beat them 8:1 for 2014 world cup. When me open door, Irumole con say him dey comot, dat one no be problem and say he do well for me. I dey lie down wen person knock my door, na who dey dere "it's me Fumnanya, can I come in" Fumnanya dey yarn. Yes oo, the door dey open. "I brought you yam and egg vegetable sauce with fried plantain" Fumnanya dey yarn. Hmmmmm you sabi the matter and you do well for me but I no feel like to eat. "You opt not to take your drugs without meal, don't worry I would eat with you" Fumnanya dey yarn. Ok bring bottle water from fridge, na so we chop finish, no word come out from our mouth except thank you and your welcome. Me con dey look her like DSTV wey dey load, whether words go come out as a sharp guy I need to break the silence. ...After many beating around the bush, I con tell her say the way I love her be like assignment wey I copy, wey I no fit explain. She just dey blush, wen I put hand for her neck, the next thing wey I dey my mind na to kiss her na eem remain, before I say Jack not even Robinson, our mouth done jam each other. We just dey like dat for one minute, before my hand con dey explore her body. Me con help her pull the gown wey she wear, her body ignite my head like say na two rock jam each other. Na so I put mouth for her br*ast, suck am one after the other. She con move body go up, as I take pull her p*nt comot, her p*ssy be like fresh palm wine wey I need to tap. I dey suck her p*ssy join with my finger wey dey brush inside, her body dey vibrate like say na nokia 3310, me no gree stop until her engine knock. Na dat tym my d*ck aka 'spatarcus kill dem all' ready to enter arena, as I dey pump her, she just dey scream 'ovrigado' say make I no stop. As I wan cum she just kneel down, collect everytin for mouth. She just cuddle for my body, as we dey yarn tins about life before she con say she need to go house before her uncle go dey find. The night still be like baby, so I need to chop meat, na so I waka go aboki wey dey we area. As I reach there my phone con dey ring, na Ifetola Gold wey we dey work together for work call me, he tell me say oga won see me first thing in the morning. Aboki give me suya 500 naira and put pepper well oo. 'Na eem be dis' Aboki dey yarn. Say you get POS. "Kia me no know dat one" Aboki dey yarn. Do make you dey support cash less policy oo, na ur money be this. As I match enter my compound, after I done greet my goons dem like wrestler wey won enter ring go fight, na so NEPA bring light and I con dey play music Sean Tizzle album 'The Journey'... I just notice some kind of noise wey no normal, I be won lock up but my mind no gree settle down. Na so I put ear for window side, I con dey hear men voice as dem dey whisper, see trouble oo, men done con do breaking and entry for we compound and me no get anything to drop. As I dey gather all the money and better things to submit wen my turn reach, na so I hear wen dem burst one door con ask "ni bo ni iyara Big T wa *where Big T room dey*" One of the Men dey yarn. I just know say ee don red for me and I need to do something before something do me. Na so I carry my bed up, collect my cutlass wey dey under there, the cutlass done rust but na the perfect tool for the job. As I rest body near my door, na so one of them use leg burst the door. I no even let am waste time, as the light self dey on, na eem I hold the cutlass like gladiator wey dey arena. I con use the cutlass give am tribal mark from face reach him hand, na so the gun fall enter one conner. I just off light, con give am finishing as I take pick him gun. I just use sense come out of my room, con squat waka go front small, wen I con jam one of those men. For dat same position, na eem I take pop bullet for him body, like say na champaign, for my mind I be like Bruce Willis, na so the man shoot me for chest. Time to die never reach oo because ee get many girls wey I never pansh, runs girl wey I never bleep, motor wey I never drive... I con manage stand up from where I dey, na so three men stand for my front point me gun. ee no even tey wen I remember their faces, say na those armed robbers wey I jam for Mama Gbenga store. "So na you be the Big T, oya take this one" one of the men dey yarn. Na so dem start to dey shoot me like thief wey dem dey kill for firing squad. Chia there is God oooo na so I take die... DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 6
12 May 2015 | 23:48
0 Likes
dat 1 no b reality oo.na dream u dey dream...
13 May 2015 | 02:45
0 Likes
Abeg the dream don do its time to wake up
13 May 2015 | 08:21
0 Likes
You dey dream for hospital arbi...
13 May 2015 | 09:36
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 6 Na so I take jump comot for bed, my body dey shake like earth worm wey dem pour salt. I no believe say na dream I dey because everything wey happen be like real life. I thank God oo say na dream. As I look time, na so I see 07:43 AM dey knack, see kasala don burst, how I wan take reach work on time today and my Oga wan see me ... As I manage reach my work place, I go meet Ifetola Gold wey deliver message give me, say where oga dey. "He's inside the office, probably waiting for you" Ifetola Gold dey yarn. You do well, as I match reach the door, my heart dey drop sound like Mastercraft beat *one producer like dat*, because this my oga na Mr. Awotunde and na person wey I done see once or twice before and any time wey he show face na something wan happen. 'Good morning sir' na so I greet am before he look back. "What took you so long to get to me" Mr. Awotunde dey yarn. 'Hmmm I be dey...' *the words no gree comot oo*. "Well take this letter" Mr. Awotunde dey yarn. Thank you sir, as take I collect the letter from him hand. "the letter is to inform you that your service is no longer needed in this organization hence forth" Mr. Awotunde dey yarn. I no even shake, as if I be dey expect am and on top I be Big T, I go survive na time ee go take. Na so I stone everybody for work place the news, the thing affect them like fuel subsidy but them no fit do anything. I con call my yoruba love say I won see her and I dey come her area where she dey work as fashion designer for one plaza like dat, say make we meet for one eatery wey near her. ... I dey for the eatery, dey flex my origin as I dey watch '30 Days in Atlanta', my belle won burst with laugh wen AY say 'their father! no sorry na oyibo land we dey, their dad!, their dad!'. As I sight Seyi *my yoruba love*, my eyes almost turn opolo eyes. The way she package, as if na miss naija dem won crown, my mind settle so tey I no remember my problems again. Na so our body join together. "Ololu fe mi, ki lo shele *my love wetin happen*" Seyi dey yarn. Na just small thing oo, how work na. "Fine dear" Seyi dey yarn. Make you no vex say I dey disturb you oo. "Not at all" Seyi dey yarn. Say you remember yawa wey gas, dat day wey you come my place. "Yes I do, what about it" Seyi dey yarn. I dream am oo, say dem con kill me. "God forbid, such would never occur to you" Seyi dey yarn. That one self dey one conner, dem done even sack me for work *na so she hold my two hands, as water comot from her eyes*. "Am not happy about all this trials your facing, am with you till the end and what are you going to do now" Seyi dey yarn. I won go see my parent first thing tomorrow. "Ok dear that's good, I got something for your mom"Seyi dey yarn. .... As I waka go her store, she give 12 yards of wrapper and one bead wey. Wey make noise before I get my self say I done think go. ********my journey waka well, as I take reach my parent side. Everybody just dey hail me Big T! Big T! Big T, dat one small self, wen all the aged people con dey do twitter role call #see_Big_T_of_yesterday_don_grow_oh. I manage reach house my family dey around, we story well. As I take give my mummy the gift wey Seyi send for her, she pray for her. The part wey sweet me pass na wen my mummy make me believe say 'there is no place like home', na so she sama me better pounded yam with banga soup followed by jack *the dog wey dey our compound*, them slaughter the dog because of me, I con dey feel like prodigal son wey return. Night reach me and my guys them, they flex for we area, as time to sleep reach, me just bath and I con talk to my yoruba love phone. Me enter my room, so I fit enjoy better sleep for once, na so I see one letter on top my bed. The letter get one kind blood like logo for body, when I open am I just ... DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 7
14 May 2015 | 03:54
0 Likes
Make una no para abeg, na Real Madrid wey go lose no fit make me type anytin at all. Una good morning oo
14 May 2015 | 03:58
0 Likes
.........Biq T......... Ur yoruba love ez a qud qal oooo........ Abeq open the letter read jorh anitin wer u c,,u yarn we still dey ur ßak......next Plzzz
14 May 2015 | 04:50
0 Likes
Lolzzzz
14 May 2015 | 05:57
0 Likes
The letter reads (watch your back)
14 May 2015 | 09:36
0 Likes
next one jo, okklad dey yarn
14 May 2015 | 12:28
0 Likes
Hahahahahahahaha una won burst my head, no worry na that jack *the dog wey dey our compound* I dey morn am for my belle, if I finish I go update una. Una don dey fall my hand oo becos the letter get red all of una con dey fear or you no know say na love letter be that...........OSUSUTALKS dey yarn LOL
14 May 2015 | 13:17
0 Likes
Åβȋ na bomb letter wey dem send ț¤ one journalist like dat..
14 May 2015 | 13:32
0 Likes
Hmmmm see tori...still waiting!!!
14 May 2015 | 13:32
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 7 The letter get one kind blood like logo for body, when I open am I just see my name for BLOOD LETTER. "Dear Big Timothy, you crossed the path of the un followed. We got our eyes on you and what we want, we shall get. Which is blood for blood, life for life. Your are a prey to the COLD KNIGHTS and you must go down. You won't see it coming". Na so I look inside the room, con dey wonder how person take put the letter there, I go ask my people for house Whether them see anybody wey drop something for my room, them say no. Sleep no gree catch me because I never know who be this people and me never do any body bad thing before. I know say ee done red for me and I need to comot for my parent place, before those people 'shoot bird miss him mama fly. Before fowl make noise for morning, I done waka comot from house so that anybody no go know apart from my parent, because I even beg dem make dem no tell anybody say I don comot. ...I dey inside bus, wen driver dey knack better song, but this track na die as my voice loud pass '...no be you I carry come but na you I go carry go' *Kiss Daniel 'Woju'*. Next thing wey I notice, the driver match brake like who Road Safety stop, I con dey wonder, as I see two motor wey double cross us like say dem dey act 'Need of Speed' for niaja road. Two people come down from each of the motor and I recognize say na those men wey come attack us for mama Gbenga store. Na so dem shoot gun for air, as me bend head make dem no shoot me. Na eem dem point gun for my head, as I look up, chia I almost cry as na fine anty *Fumnanya* dash me better slap with her small hand, the sound do wiiiiiiiiiiiii for my ear, as if person blow knockout for inside room. Before I get my self from the slap, one of the men knack me gun for head, hmmm everywhere turn black and white. +++++++++++++++ I no even remember anything at all, my head be like memory card wey china phone format. As I dey get my self small small, I notice say na chair I dey, dem tie my hand go back, con still blind fold me. I just dey wonder wetin I do all this people, all my body be like load wey heavy, as power don reduce. The big thing wey dey my mind na Fumnanya wey I see, this girl surprise me, she no even act as if she know me, not even love me. Time pass, na so I hear the door sound as ee open, I dey count how many leg the person put for ground before ee go reach my side. 1,2,3,4.....as I one count five, na so water pour for my body. The person no even loose the cloth wey dey my eyes, as ee con dey interrogate me, see beating. The most important question wey the person dey concerned about na 'who I be' and 'who I dey work for'. Me no even answer any one. Until he vex go. Ee tey well before Fumnanya con enter the room, this time she waka come like better person with food. She say if I eat finish we get something to discuss. My blind fold and my hand wey dem be tie, con loose so dat I go fit chop the food wey dem bring come. The light wey dey my front, over full I no even see any thing as she take waka comot. I chop the rice wey dem bring, because na only God know when I chop last and make autopsy no go talk say na hungry kill me. After I chop finish I con dey study where I dey, na one room wey no get window, na only one door and two chair with table. The door open again, this time, two men follow Fumnanya enter inside, I just pretend like say I no get strength again. "The reason you are here mr. Big T, is that you have crossed the code of conduct of the COLD KNIGHTS. Attacking three of our men and compromising a high rated mission and you shall go down for it" Fumnanya dey yarn. I just carry head look am with strong face, she no mind me as she continue to dey talk. "We got eyes everywhere, we know everything. ;"Your yoruba love Seyi" Fumnanya dey yarn. I happy as her plenty talk finish, na eem I done use stlye take one of the utensil tey cut one of my hand wey dem still tie. As she con talk the one wey shock me like high tension, "give him the injection with the tag '32BFT', if he survive, then we can commence the next phase" Fumnanya dey yarn. Na so she and the second man con go outside. I survey the place, as I pretend like say I no know wetin dey happen, na so the man carry the injection dey waka near me, while him gun cross neck. I quick do quadratic equation, wey na matter of life and death, if I attack am ee go shot me like hunter wey catch meat or the others go come interfere. As he take bend my neck, so he fit inject me. Na there he make mistake, I just use the table as weapon, tey push am go back. Na so I catch him hand, twist am tey chook am for neck like the one wey Daniel Bryan do for Batista for 'Wrestlemania 30'. The man fall for ground, con dey shake as if he catch imbecile. People are bad oo na wetin for do me be dis. I con waka open the door, as I look around whether camera dey look me, I no see any one because the house be like normal one. I just use sense find way reach the backyard, as I take jump the fence na so I hear POH! POH!, but the bullet no touch me, as I reach ground, I tear race as if I dey do run for Olympics but two men con still dey pursue me. As I look back one done point the gun for my body, na so I jump enter bush. Na God save me Because na one small pit I fall enter. Next thing dem scatter bullet for where I dey, based on say dem no see me, no one touch me. Na so I hear "Ma, we've lost him, okay we are on our way" one of the men dey yarn. Na so dem waka go. I trek to the extend my shoe con sabi road, night done dey reach wen I burst enter main road. I stop motor tire, but no one gree stop. Na so I hear "we got him" one of the men dey yarn. As I look them done park car for my front, na so one point me gun and the other dey make call. As one waka near me, with vex wey dey my eyes, I just dey follow am with sense, till I reach near the motor. As dat one wey point gun for my neck dey my back, dey follow me. "Get in the car" one of the men dey yarn. Na so I take do like say I wan enter the motor, wey give am elbow for belle, as he shout con won shoot me, na eem I con do like Rambo take collect him gun. As the tin dey happen the other won no even worry, as he take shoot me but as a sharp guy I just fall go ground na so the bullet touch him second for chest. Me just shoot am for leg, as he dey fall, I shoot am again for head. I just dey happy say I done see motor wey I go drive go house. For like two hours I dey road dey drive and still dey think how my parol won take be, I just confirm say I dey go my yoruba love place first. Na so I see one of those men wallet for the motor, I check inside, the money reach 7500 naira, na so I take the money, I no even look wetin dey again for inside the wallet. As reach Seyi place, my cloth be like who win Gulder Utimate Search as people wey know me dey Question and Answer section: ki lo se le *wetin happen*. Me no even answer dem, me just run enter inside, when I reach Seyi room, the door dey lock. Na so I ask the compound people, them say dem never see her since morning. Na so I waka go use all those people wey dey make call phone take call her. The number ring two times she no pick.Next one na man voice I hear. "Hello Big T, I told you we got eyes on you and we are every where. Its Mr. Awotunde speaking to you and we got Seyi here with us" Mr. Awotunde. DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 8
15 May 2015 | 02:11
0 Likes
U r in 4 it,naso den go take kill ur luv,so painful
15 May 2015 | 03:47
0 Likes
wah the fuck.....mehn lehme assist you in vhis mission
15 May 2015 | 04:20
0 Likes
Shuooo............ Dis quy u tite ooooooh,,u took down 2 people by urself..u are really in danqer bcos the cold kniqhts quyz wil definitely cum bak 4 u....... "Jex prayinq nofink appenz 2 Seyi" next plzz
15 May 2015 | 04:36
0 Likes
chaii see pidgin English I still dey learn work
15 May 2015 | 07:13
0 Likes
Who be Mr Awotunde
15 May 2015 | 07:22
0 Likes
Oh boi!!!! Dis ur pidgin na die.. Weda u like am abi u no like am.. I don land gidigba 4 hia nd na we two go finish dis story... Dis one wey u come dey perform action...i no knw sey we don get jackie chan 4 naija o.. Infact ur case pass be careful... Even ur boss dey follow reason ur mata...drop d next tin mah see
15 May 2015 | 12:00
0 Likes
Haaa big T nice one bt bcareful
15 May 2015 | 12:14
0 Likes
Laff wan kill me 4 here,BIG T make d tape dey roll....na charlywizzy dey yarn....
15 May 2015 | 12:25
0 Likes
Hmmmmm
15 May 2015 | 12:27
0 Likes
Mr. Awotunde na Big T oga for work and the boss of COLD KIGHTS @charliebryn. Na how yu wan tak helep Big T @d00zIE. Yur head be like fufu wey dem stone wall, as yu done land so, make yu remember say no be only yu waka come and we 2geda na so dis story go end.....Big T pass Jackie Chan oooooo naa Coolval22 Badoo he be @Tenniebenson. Bross no worry na our pap language be dat oohhh @Olamy4fun .......@Jclash dey yarn
15 May 2015 | 13:30
0 Likes
E be like sey u wan make i turn hot knight deal with u.. Hehehehehe na my head u dey use do experiment? @Charlywizzy @Charliebryn @Simzy @MosesMichael @Gracy @evrybdy wey see as @Jclash dey use my head play... Make nobody beg me when i enter him nose o..cos if i enter lasan uhmmm.. D fire wey go happen go pass 9/11 own wey shele 4 America... Ok..cos na Tenniebenson dey yarn o
15 May 2015 | 14:18
0 Likes
I 4 like witnes the event oo action is wat i want see b dat @Tenniebenson
15 May 2015 | 15:24
0 Likes
I go help U enter his nose with U @tenniebenson
15 May 2015 | 15:29
0 Likes
@dOOzIE u wan make dos people kill u abi.u beta sit down where u dey..
15 May 2015 | 15:44
0 Likes
@jclash Ok.... @Tenniebenson I want you to enter yourself
15 May 2015 | 18:47
0 Likes
@Tenniebenson na joke I dey ooo
15 May 2015 | 20:28
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 8 Na so I call my mummy with another phone. "Hello, am in the hospital now" my malle dey talk. Wetin you dey find there by this time or them they share mosquito net for the place. "Not at all, you dad was attacked by strange men, they shot him twice, I pray he survive it" my malle dey talk. Mummy abeg hold body well oh, I dey come meet una very soon. As I make the call finish, me know let her know wetin do me so if fit avoid stories that touch. I just beg the guy say I wan use the first phone he no gree until I forward am 4K. My waka now na to go see Ufosky my computer geek, because ee get wetin I want make him do for me. As I drive reach him compound, I just look the motor well well, Whether I go see anything wey fit give me better clue, I just no understand because the motor be like wetin them gbab from another person, na so I vex carry the wallet. I knock Ufousky compound gate, so tey na stone I con dey use. "Kia who I be for there" Gate man dey yarn. Na me Big T. "Me say Big Tree, walai here no be forest" Gate man dey yarn. Suleman you know remember me again, abeg na Ufousky I dey find. "Make I come tomorrow, you go see am for Ufosky" Gate man dey yarn. Oh this aboki won spoil my show oo. Hmmmmmmm na so I say 'SAI BABA!'. "SAI BUHARI" Gate man dey yarn. As he take open the gate for me, I just happy. The compound na four flats, as I knock the door, Ufousky open am sharp sharp. As I enter inside the room, kweke! Kweke', na fat be this, Ufousky you won kill urself, anty good evening oo. As I take greet Ufousky girlfriend wey fat like cow, all of them con dey laugh. Me and Ufousky con enter him workshop, one place wey he dey do him computer things for him house. I upload everything wey dey do me give am. "I don hear, wetin you dey plan to do" Ufousky dey yarn. I just want you update me, the location of the last call wey I make with this phone,this wallet check the identity of the person and every infomate wey you fit get about COLD KNIGHTS. Na so ee knack the computer me just dey chill with one bottle of origin, na so he give me every informate wey I need to know. The person wey get the wallet information wey he tell me no dey relevant at all, he no get link to COLD KNIGHTS. "Hmmmm this 'COLD KNIGHTS' hard me to crack but I done run am oo, them be dirty killers wey dey pia people for their selfish reason and them never even spread at all, na new gang" Ufousky dey yarn. Ok I dey feel you, abeg tell me more. "Mr. Awotunde be their oga and Fumnanya be their Squadrat Queen *second in command*, but them get strong weak point" Ufousky dey yarn. Tell me their weak point *na so I draw my chair near am, he con give me better strategy wey I go use take treat their f*ck up. Me con give am the key of Toyota Civic wey I pack outside, sake of say, I no know Whether I go survive the mission. The things wey done do me, my daddy wey dem shoot and my yoruba love wey dem kidnap, I know say my odd to survive fit be 1.01 like Real Madrid vs Genova. Me ready to die for Seyi, so dat we country go mark my name as naija Romeo. My next waka na Irumole place, as I fall in enter, he recognize my voice as he open. Me yarn everything wey dey sup with me. "Guy, this no be one man fight oo, you need to report give police" Andrew dey yarn. Abeg no worry yourself, my head strong like cement wey soak water, for this matter. "I get one of my guy wey fit help you with tools" Andrew dey yarn. Na so we enter motor take move go 22 Coolval street, one local setting be the place. The person wey we go meet na Pizzaro and Solace, as I reach there my mouth drop water, see guns wey reach to fight world war. Na so me take everything wey I need join one bullet proof vest. I still con call Ufousky wether any changes dey. "No changes, but I go like make you quick reach there oo" Ufousky dey yarn. You do well as I take cut call. Na so Pizzaro con say he get better power bike for me and say anything wey happen he dey my back. ********** I just dey cruze the power bike with better speed, as if na those android bike games I dey play, if you be dey motor and I drive pass you, hmmm! Na only sound you go hear. I con drive enter one lonely part, I con sight the location wey Ufousky tell me, na so I take pack the bike for bush, con trek waka reach there. My mind dey beat but I no dey fear at all, as I reach the gate, I waka go the side of the compound, con jump the fence. As I land .........*drum roles* ghen ghen ghen ghen ghen ghen eh shin shin shin carry pomo.... DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 10
15 May 2015 | 20:32
0 Likes
Chai! dis ur tori hav make me remember our childhood adage wey say actor no dey die at all commando T ride on!
16 May 2015 | 03:52
0 Likes
*Actor no dey die* I no say our goons don dey do action film..
16 May 2015 | 05:48
0 Likes
@tenniebenson no worri,i go bet my money 4 ur head,cos i kwn wetin u mouth[just mouth alone,na she get o] fit do,lolz
16 May 2015 | 05:49
0 Likes
@Tenniebenson abeg have mercy on him for now, make him finish the story first ooooooo gracy dey yarn #lol
16 May 2015 | 06:35
0 Likes
@Tenniebenson abeg have mercy on him for now, make him finish the story first ooooooo then after you sabi do anything you wan do, even if you wan enter him ynash.. Carry dey go......... Gracy dey yarn #lol
16 May 2015 | 06:37
0 Likes
Me baa i don dey ready with my AK47 infact na me go face their leader
16 May 2015 | 06:47
0 Likes
naija...hmmmmm
16 May 2015 | 08:46
0 Likes
Lolz......... Pizzaro na badt quy 4 dis story ooo imaqine him harbourinq ammunitionz unlike the real pizzaro........no worry i dey ur bak wid my double barrel qun ani nonsense u let me knw lol....... Nex plz
16 May 2015 | 09:16
0 Likes
Lolzzz.. @Jclash u don see sey no be evrybdy wey dey follow u laff love u? See as dem dey talk sey mah enter u... No worry i go pity u..cos na my paddy u be... I no fit chop 4rndship eyes... @oluwaseyi its Tunde on d run... Jclash is correct.. (na #JSS1 i read dat tori)... @Jclash na woman fit do dis job 4 u wella o.. Better employ me mah finish all of dem sharparly... U no knw sey women get skunk 4 head sha... I don knw sey dis Pizarro na badoooooooo him name sef dey fear me
16 May 2015 | 11:15
0 Likes
Abeg guys is dis 9ja james bond(007), anyway bros carry go bt no 4get see na 9ja u dey no be yanki, so if u con die 4 ur yoruba love she go quick quick 4get u marry anoda guy ooo, nd u sef go be "foolish romeo
16 May 2015 | 12:44
0 Likes
Chain my boss man,no b only u Waka home. Just try mk dem no suv u cuz I dey enjoy all d stunt wet u dry perform for yonda so. Well,make I dey loom nah as okpolo eye no b open eye @jclash
16 May 2015 | 15:44
0 Likes
big T me too i dey ur back with a.k.99 no wory. @Tenniebenson u fit shoot pistol? this one wey u dey make mouth say u go finish them sharparly..... if i see u running 4 ur life, my own na to laf oo lolz
16 May 2015 | 16:33
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 9 As I land like pilot wey no get parachute, me just enter ghost mode *dem no dey see me*. I just bend down near one tank like dat, so dat me go fit use eye take sample the area, the place be like one abandoned duplex. My mind dey read many things, because I just dey wonder why I enter this kind gbege! and matter con dey hard. But man na man, me no go relent, I must do wetin I fit do to save my yoruba love. Na so I sight two men, them carry gun and them be like soldier ant wey dey duty, from were I dey I just calculate my steps well, as I take wear my gun eem condom *silencer*. Me gum wall, like wall gecko, con waka small small reach were dem dey, na so I shoot the first one for head, before word fall from the other one mouth, him too collect him share. I con move their body put for conner, con search around, I no even hear any voice, the place be like grave yard. I hold my gun well, me con open the door wey remote person enter the house. As I chook head enter the house, na so I hear gboa! for my head, my head read star like Tom and Jerry, I dey sure coco go grow come out. As I get my self, my gun done enter under one chair and the silencer don divorce my gun, this one na big f*ck up ooo. Me con look up, na so I see person wey grab like Davido bouncer, con carry waist as if na Johnny Bravo. Before I know wetin dey sup, the guy carry chair won still knack me, na so I bend down take give am elbow for leg and con role comot from there. I con stand up, as I near am make I dash am my fist, na so I recive my own first for waist and chest, na blood turn close-up for my mouth, as my body shout 'over load'. Na eem me con give am three round of blow for him body, the man no even shake at all, he just do like say he put foam for body. Na den I know say ee don red for me, I just waka dive am, the mumu follow me too dey run, for my mind I won do wetin Jet Lee dey do for film. I just count three legs for wall, con do back fleet take go the man back, as he look back I done already hold my gun. Na so I give bullet for body but he con dey do like Robocop, as he still dey struggle dey waka come my side, na so I give am last card, finishing for him head and con hala 'check up', as he take fall go ground. The gun wey I shoot that time done wake people wey dey the house, as I dey smile say I don fall Goliath, na eem bullet fly pass me. I no even bother to look back, as ijump for the back of one big chair, the chair role go back as the chair turn shield. The shooting be like were compound to compound dey use banger fight, the chair wey I dey done dey bring smoke come out. As I look na five people I see, them done stop to they shoot, two of them done they waka dey come my side. Na so I use my Bullet Messenger *gun* take shoot them for chest, na eem I waka comot from that place. Na so one near me, as the man shoot, I just rush bend down give upper cut, as I take hold am for neck, con use the man as shield wen him fellow people dey shoot me, the man be like better brother keeper as he help me collect all the bullet for body. I just give the remain two better head shot, as them touch ground. I search all the rooms I no dey see any sign of Seyi, my mind done over think wen I open the last door I just see her. I just stand like those three Eko statue wey dey hail you welcome to Lagos, na BOMB dey my yoruba love body. I waka near her, as I comot the celletape wey dey her mouth. "Baby please don't touch it' Seyi dey yarn. *her eyes done soak with pipe borne water*. I no talk anything as I waka go find phone, I collect one from one man like dat wen don puff. I dial Ufousky number, the thing say *the number your trying to call is incorrect, please check the number and dail again*, my mind fly, I try another one before the number con go, na so he carry phone. "Hello, who's on phone" Ufousky dey yarn. Na me Big T. "You never die, abeg the motor still dey if na wetin you want be that" Ufousky dey yarn. Abeg I wan make you help me diffuse one bomb wey dey my girl body *na so I describe am the type of bomb for am*. "Ok take better deep breathe" Ufousky dey yarn. I do do am. "Good, na how many wire you dey sight" Ufousky dey yarn. The wire many ooo. "Omo see gobe, na how many red dey there" Ufousky dey yarn. Na only one dey here. "Say you get anything wey you fit use take cut am" Ufousky dey yarn. Yes oo, small knife dey my hand. "Cut the red one, and tell me wetin happen" Ufousky dey yarn. Hmmmmmm I still dey alive and the time stop con start again. "Ok, na how many minute remain" Ufousky dey yarn. Na 45 seconds. "Once the time knack 20 seconds, cut the green one" Ufousky dey yarn. Ok I done hear oo*23....22.....21.......baby I love you........20* hello Ufousky you still dey dere because the time done stop. "Great job! Abeg go update ur status for facebook and coolval22.com say you done disable bomb. You do well for me no worry I go use number as phone a friend for 'Who Want To Be a Millionaire. As me just comot the bomb from my yoruba love chest, na so my yoruba love hug me as if super glue dey between us. I con notice say person dey waka enter the room through the mirror wey dey the room. Na Fumnanya, as I wan turn back na so she shoot, but me just push my girl fall as I take pull two bullet for her chest. She just fall go ground, me con dey happy. Na eem MR. Awotunde just enter the room with two gun for him hand, as he take... DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 10
16 May 2015 | 20:48
0 Likes
Big T you don turn rambo weldone hope u go win the last fight betwin boss and actor.
17 May 2015 | 05:24
0 Likes
Big T baba...dey take bullet for chest like punch...
17 May 2015 | 05:48
0 Likes
Lol
17 May 2015 | 06:57
0 Likes
@BIG-T, Na wa u o! Sake of sey I qo pee na eem u won use d opportunity take end d tory finish abi? Anywyz, I don show aqain, & hope sey u qo fit perform all dis ur Jet Lee styles dem 4life cos all dis free style dem don dey pass Jarkin Chan own o ahahahahaha..........
17 May 2015 | 06:59
0 Likes
Try using english den u cn spice it wit smal pidgin am kinda geting bored... Bt i must confex u av a realy intresting stnry here...
17 May 2015 | 08:53
0 Likes
Oya na, we dey wait..... abeg no repeat episodes again.
17 May 2015 | 09:54
0 Likes
Big T commando hehehe
17 May 2015 | 09:54
0 Likes
Baba don be commando o
17 May 2015 | 10:05
0 Likes
Hope all these no be dream
17 May 2015 | 10:42
0 Likes
Na so me sef wan ask o @gracy cos na inside film i dey see sey one person go kill 100
17 May 2015 | 11:46
0 Likes
wat nxt nw
17 May 2015 | 11:50
0 Likes
hmmm
17 May 2015 | 11:56
0 Likes
How many people wey u don take down so......mr Awotunde can neva be a problem jex qive him ur usuals i.e either on the chest or head.......... Nex pleeee
17 May 2015 | 16:24
0 Likes
Lolzzz na so ooo tennie
17 May 2015 | 16:44
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 10 MR. Awotunde just enter the room with two gun for him hand, as he take sit down for chair wey face me and my yoruba love. Hmmmmmmm! My mind fly con lost like Malaysia plane, that cold wey dey make person update weather for two catch me. Me no even know how the thing they do me, I need to chop better liver, dat kind one wey Mama Chika dey sell or else my matter go turn Story for the Gods. "We meet again, but this time in a decisive moment" Mr. Awotunde dey yarn. Na so we see am *Seyi just gum for my back*. "I have an offer for you, this is something that would change your life" Mr. Awotunde dey yarn. Na wetin be the thing. "I want you to join my team, bring justice to its call" Mr. Awotunde dey yarn. Dat one no fit happen, I be one man mopol. "Well this is the opportunity......" Mr. Awotunde dey yarn. I no let am talk finish because plenty talk no they full basket. Na so I quickly shoot am before he go think about am, na there I know say na only me waka come. My gun just sound fiak!, bullet done finish oooo. "I told you before, you won't see it coming" Mr. Awotunde dey yarn. Na so he take shot me with the gun wey dey him hand, na eem me self fall go ground. ******************* My body won peel, as I fast remove the bullet proof wey save me. I use eye find Seyi, I no even see her, even Mr. Awotunde. I con run go outside, as I take see as motor wey them they. I con pick two gun for ground, as I pursue the motor with my leg, na eem I con reach were my power bike dey. Me just tear speed as if na Etisalat Easy Blaze I subscribe. I burst enter express as I take they fire pursue them. I divert go left this man block, I follow the other side na still the same thing. Na so I vex turn Ghost Rider, as I put speed wey na only one tire I stand with. The skills wey I do, make me pass am go far and I dey sure say he no see me again. Me con face am they drive come back as I hold my two gun for hand, na so I take shoot the two front tire at once. But na God save am because he don already slow down na so he crash go one side of the road. Me just waka reach were he dey, as I come down from the power bike. I just reach there, I open door con give blow for head na eem he take catch my hand, as he take knack am for staring, he still con punch me for belle as, I fall go back. Na eem we take position like say na May weather vs Manny Pacquaio. The punch no be here as we take dey exchange am with flash share, he give me and I give am. Body no need to remember wetin ee dey collect, as I take dive am go ground. Me just dey untop the man dey pound am with blow as is na akpu, na so he take something take knack me,n I no know wetin be the thing as I take fall comot for him body. The next thing wey I see na the man carry gun face me, as I look left and right nothing wey I fit use take save my self. Na so my dream won take come thru, me just say my last prayer as I close eyes...POH!!!!!!! ******************* ... I check my body bullet no touch, oo! I don turn superman. Me con look up the man just fall go one side, na my yoruba love I see wey stand with gun. Her body dey shake, na so I waka go meet her. "Ololu fe mi, mo ti pa eyan *my love I don pia person*" Seyi dey yarn. No na, you just save my life. She just dey cry, me con pet am as she take climb my power bike, we con zoom comot. Wen we reach na her place we go straight. My mind just dey sweet me like pikin wey dem dash packet of sugar lick, as I done reach there, see as people just dey hail me...BIG_T!...BIG_T!!...BIG_T!!!...my head just dey swell as if na me go rescue those missing girls. Me just go collect better bathing as I run go make call... Hello mummy. "Hello, have been hoping to see you ever since" mummy dey yarn. Abeg no vex for me, how my old boy body. "Well, we are lucky, he is still here with us, just taking few medications and then he would be discharged" mummy dey yarn. No worry me go come house soon. Me just dey happy say everything turn out well and thanks to my behind the scene guys and my yoruba love. As I waka enter my house na so nepa bring light... DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 11
17 May 2015 | 23:54
0 Likes
Chaii! jackie chan,rambo, commando, bruce lee , jet li... al of them go dey jealous nw... if u travel go china 4 film shoot u don make am be dat... jst see d way u dey release punch, combo, karate... bt i wan beg u 4 sometin... #bring back our girls. pls
18 May 2015 | 01:53
0 Likes
Lol@scholes na so#our girls o
18 May 2015 | 03:12
0 Likes
Lol......Biq T don turn celebrity overniqht........... One quy don take down a whole squad........... Bravo.....nex pleeee
18 May 2015 | 03:37
0 Likes
More adventures dey come Mr Big T. Abeg fastforward am to next episode pls...
18 May 2015 | 03:46
0 Likes
So na BigT do *kungfu hustle(axe men)*
18 May 2015 | 03:53
0 Likes
No be smal thing @big t nice one, abeg try help us join naija soldier to #bring back our girls
18 May 2015 | 05:15
0 Likes
Oh boy this one pass jack chan
18 May 2015 | 07:54
0 Likes
Lol... Dis ur freestyle jez dy sweet ma belle..
18 May 2015 | 08:34
0 Likes
Big T! Big T! Big T! Big T! Na u sure pass jawe...Nigeria Jackie chan..Jet li and Rambo including steven segal {Dt man wey nobdy fit beat n bullet no fit touch am} nice story sha
18 May 2015 | 11:04
0 Likes
Dis 1 na "BIG T PRODUCTION", & plus 2qether with James Bonq's Free Style(s), con follow join with d oriqinal Bruz Lee Kon Fu.............. @BIG T, wt all dis ur free style(s) dem, e don reach u 2 take open 9JA Kon Fu skul o, abi hw u see am? Lol.......
18 May 2015 | 14:58
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 11 ...As I waka enter my yoruba love house na so nepa bring light, me just drive my body go bathroom so I fit wash away my sorrow. Omo see que for there, hmmmm! Ee remain small make I ask Whether them dey share money for the bathroom. The person wey dey bathroom no gree come out and no water sound self, as I won para, na so I see 1000 naira for ground, see me see better. Me just shadow con watch before I go pick am, nobody even notice am. I just waka near the money, me won pick am na so person pass, I just put leg on top, con dey sing ...emi lo ba se, na me be king kong.... *Vector - king kong*. 'Bross say you never ready to bath, na your turn oo' na so one babe like dat yarn me. Abeg no worry, you fit go bath because I never ready. Plenty time waka, me still dey dat spot as people tey clear comot, me done know say time done reach to do Western Union Money Transfer from ground to my pocket. I con bend down pick the money, na so I hear PAA!, na person knack my hand. Fear catch me like the one wey EFCC dey catch person, me con look up. Na so me hear, 'say na your own oga Big T' na one small boy just relay words give me. No vex I be won use finger print take find the owner before, me just carry my head put for ground, as I waka carry my bucket enter bathroom, with confirm ELA!! and shame. ******************* Me just carry strong face enter my yoruba love room, me chook leg enter inside, na so I sight wetin fit make hungry hala MIA *Missing in Action*. Table done set, na confirm semolina, the wey the packaging be, I fit tell say na semolina and no be semovita. The soup na dat kind wey go make you wet as in your tongue, na better bitter leaf soup with cat fish wey still fresh and my one bottle of origin con top am. ....as I chop finish, my body be like say no be me get am, na so I struggle enter bed, me greet my yoruba love good night and warn her say I won crash and make she no disturb me, sake of say I won dream better 2sure wey I go knack for Baba Ijebu for morning. ******************* *D.J Tenniebenson_me and my guys oh, say we go sing song, say we go live long* The D.J just scratch that song as me and my guys dem enter the club. Na big time party things for us, we just collect centre table, na so we order for posy*na wheel barrow wey different type of drinks dey and na 1 million be the price*. For the table so na me Big T, Charlywizzy, Escaysegzy, Simzy, Doozie, Okklad, Scholesjnr, Khola, Stanny, we dey flex better. Me con sight won babe wey done dey look me since, na eem I waka go meet her, after plenty talk we con enter room. As the babe pull cloth, my spartacus almost tear my boxer, me just chill as a guy man wey I be. The babe just near me, as I done off load my clothes, she just bend down put my joystick for mouth, my head ring alarm. I done almost release na so person just bang the door open, me won stone the person slap, why na that crucial moment the door go open. As I look person wey stand for door na My Yoruba Love, na eem me burst window come out, na so I wake up... ...As me open eyes, na eem I just gum bed, see wetin I see, my yoruba love just serious dey suck my d*ck, her bobby con dey swing go up and down like jagilova. Next thing I just hear..."Baby, hope I did not disturb your sleep" na Seyi dey yarn. No na, you even helep me turn am to reality. Me con shoot everything wey dey my d*ck enter her mouth, as she take swallow am but stain am small for face like pikin wey dem feed akamu. Me con put dics two, as I dey un top her, me con kiss her as if tomorrow no dey before I enter her b*east. As I put finger inside her p*ssy na, so she shout 'baby faster' me na boos for the matter, as she take cum, all her body con weak. Me con put my Spartacus inside her, me rock am well well, until shoot another load like cannon for inside her p*ssy. Na so we just hold each other wen sleep con carry us go. ******************* I still dey un top bed dey cruze sleep, as nepa no gree take light, so the fan dey sama my body well. Na so person take peck me for face, me open one eye, na my yoruba love dey my front. She done dress up already like person wey won comot. Na so she tell me 'baby sorry to wake you up, am going out to meet a client to collect her measurement and some other stuffs' Seyi dey yarn. Ok I done hear you. '...and I dropped 5000 naira on the table for you to use and please don't stay out too late' Seyi dey yarn. ******************* Today na me go run this town, their fada, warri!!!. Na so I burst enter street, with no direction. Me con see one poster of Scales__Man of the Year_album, me con fall enter the shop, as I take buy two copies. The money wey my yoruba love give must yield something, I con waka go one Baba Ijebu kiosk so . Me check game wey dey play na Gold, hmmm me con collect chart take forecast better solid two sure. I con tell the person wey dey terminal say make he fire 02*39 for me and make he press am 1000 naira. .... As I dey stroll dey waka about like Johnny Walker, na so two black Toyota Amanda park for my front, the motor be like wetin never touch ground before, them tint the motor black. As me con stand for one conner dey view the motor like say I never see motor before. Na two fine chicks con come down from each of the motor, oboiy!!! See assets them carry oo, them even wear black suit, if Will Smith even see them, na then he go use take act 'Women on Black. As I done tire to look, me con press forward, na so person say 'please, excuse me Big T'. Na. Normal tin for person wey popular like me but when I look back, na those chicks call my name. As I look back, I con dey feel like. 2baba, maybe dem mistake call me, na so me con press forward dey go house. Na eem I hear am again as them take waka near me. "Its you Big T we are calling" as the chicks near were I dey. Na me be this oo, wetin una dey find, abi una done miss road. 'Not. At all, we have a message for you' as one for the chick follow me yarn. Na wetin con be the message so. 'Hon. Osusu Jeremiah Desmond wants to see you'. DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 12
18 May 2015 | 21:56
0 Likes
Lol.......viz story ez funny........... Wetin u do nah wer politican der find ya???....... Nex plz
19 May 2015 | 03:03
0 Likes
@Big T,u get mouth,make d story dey roll as e dey hot
19 May 2015 | 04:29
0 Likes
Welldone @jclash i dey feel your parole, i dey gbadu dis story like die. That politician need big T performance for james bond things. Next episode pls...
19 May 2015 | 05:01
0 Likes
Lolz
19 May 2015 | 05:13
0 Likes
Hahahahaha naso another assignment don show money go soon flow @Big T i dey feel u die
19 May 2015 | 05:58
0 Likes
New job dey ground for you
19 May 2015 | 07:20
0 Likes
Hehehehehehehehehehehe. This story funny gan, I swear. Make d tori dey flow in na cos dis Big T matter be as e get ooo
19 May 2015 | 07:40
0 Likes
I don lauf tire 4 dix tory sotey my belle dey pain me @bigT you no go fit kill me
19 May 2015 | 08:08
0 Likes
Wetin com happen oo
19 May 2015 | 13:39
0 Likes
Shey no be say dem politicians wan dy use u to dy commit atrocities for town.. Big T no go spoil ur good name bcos of money oo
19 May 2015 | 16:28
0 Likes
Hmmmm honorable indeed
19 May 2015 | 19:33
0 Likes
Hahahahaha big tym bro... another biz on the line... money go flow... chai!
20 May 2015 | 02:17
0 Likes
papapapapa biq t...i hail oh...enjoyinq vhis
20 May 2015 | 04:27
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) EPISODE 12 "Abeg I want make you read this thing......na" Osusu Talks dey yarn #lol .....Well I really do appreciate the fact that you read and followed my story till this extent, wow a big thanks to you. I just want to give you insight about this story 'ADVENTURES OF BIG T' and how it came about. Actually before putting my pen on paper to write this story, I had a very sorted out or planned story titled 'Jerry the Guy'. For like two years back or so, I kept on procrastinating that I would write the story and which I never did. Later on I was inspired to write on it, so I went to buy a 80 leaves exercise book and a pen, after writing the first paragraph I opted out, probably because I felt my line were not catchy or maybe I derailed the story. My head was down, anytime I had thoughts about the story. Along the line, 2 days later, there was no one online to chat with, nothing to do. So I picked my phone and composed an imaginary picture about someone, finally named the person Big T. I gave him a very special attributes, to be different from other people. So, then I started the first episode, I was really hungry that moment, that's why I used food for the starting. I cracked the first joke there "...Big T this ur order no be here oo say na you wan break the fasting wey Jesus do for bible...", it was very funny to me, I thought deep beneath my mind, to create something of such nature. The story 'ADVENTURES OF BIG T', I never pictured how it would look like till the end, all I did was to improvise at every end of each episodes and that worked out fine. I used my friends names, especially the ones who would read the story, so as to make them know I wrote the story, while few of them liked it and some were not concerned about it. I posted it in two different cite, It did well in the coolval22.com site. The comments, the views and the participation of everyone made me feel acceptance. This is my first story I would be writing and I caught such views from you all, am not the best writer but I would never ever relent to make your time reading my story a waste. After this story, I would go back and work more on my self and bring back another piece of creativity. What am trying to insinuate in essence, is that what ever in life you feel right about doing, be it the thought is stale or think you would be looked down upon, that's not true. Just start it, many people are there to support you, there are some hidden talents sinked down in the ocean of your thoughts, just take your time to crave it out of you. This then would bring about what I call 'Intellectual Joy', there is nothing bigger than this even money can never replace it. For the fact your the first person to read this, my special thanks goes to you and this is MTN air time***197524444438*** to replace all your MB for opening this page and reading my story. I really appreciate Coolval for the platform given to me and my story. Thanks to you all DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR FINAL EPISODE 13
20 May 2015 | 05:02
0 Likes
Wow nice story from big T congrats to d person that win d card But ur jet Li film na wa o,pls don't try this at home,school or anywhere Olamy4fun dey yarn
20 May 2015 | 06:16
0 Likes
Wow! keep up the good work dear writer
20 May 2015 | 06:31
0 Likes
Wonderful motivation there.............. Nwanu make we continue the story oooooh
20 May 2015 | 06:59
0 Likes
Hmmm,BIG T na mtn card na original?4 dose wey dey use mtn,make una confirm am abeg,lolz
20 May 2015 | 11:54
0 Likes
Hmmm,BIG T dat mtn card na original?4 dose wey dey use mtn,make una confirm am abeg,lolz
20 May 2015 | 11:55
0 Likes
Hmmmm,@sophia,hw u want make i take beliv u now,u fit prove am?
20 May 2015 | 16:33
0 Likes
@charlywizzy guy you fall my hand, ee no matter weda d card na fake or not......Thank God oo I don type the last episode finish na to chop, sleep, wake up con post am for una......Jclash dey yarn...lol were this my friend dey @Tenniebenson
20 May 2015 | 17:00
0 Likes
Motivational@jclash My wife(@Tenniebenson) dey 3D @jclash
20 May 2015 | 17:55
0 Likes
lolz....@jclash no be so na,u sef u suppose kwn say na unto jokin level,you u get mouth na
20 May 2015 | 18:24
0 Likes
@BIG T, u qet mouth jare..... Bt wait o! If u no mind, I 4like com learn dis ya Kon Fu styles make I take hold bdy small..... U no sey wt all dese insurqency dem, we country no 2 dey save aqain...
20 May 2015 | 19:35
0 Likes
Haaaaaaa oya clear road!!!! @Sophia why e be sey na u come win dat card? Anyway sha.. I no dey use emptyhen... @Jclash my 4rndship wey sure pass sure.. Na work throway me o..nepa sef come join power disturb my browsing..but devil na laya (liar)..i don show.. Next tym na etisalat i wan see o..but no post am 4 hia na personally u go gimme (dnt tell anybdy o)... Ehn ehn.. I love dat inspirational talk (write up) 4rm u.. Dat was touching..d fact is.. Never look dwn on urself..cos ppl will see u d way u see urself..raise ur head up nd see tinz u never thought u could see.. *winks*
20 May 2015 | 20:01
0 Likes
Me I no sabi use this site take send personal message oo but my fb account na Osusu Jeremiah Desmond I go smile if you stone me message 4 there.....@Tenniebenson I don one drop the last episode....chia I go miss everybody ooooo... As I promise una say as I dey do my SIWE...me go still try to dey push una the story too....all of do well for me....na small thing remain and ee be say make una no go do wetin Big T dey do because oyibo say readers discretion is advice and don't try it at home oo. Una Bye 4 now. Na me Jclash dey yarn
20 May 2015 | 20:34
0 Likes
ADVENTURES OF BIG T (by OSUSU TALKS) FINAL EPISODE 13 'Hon. Osusu Jeremiah Desmond wants to see you' as the chick take relate with me. My mind shock as if I hug transformer, the person wey won see me na confirm person for we country. Na eem be the most richest man for Africa, him surname dey for every sector of business wey dey exist. I just chill as I take ask the chicks why him won see me. 'Well, he wants to have a conversation with you' as the chick dey yarn. Me no get wetin I dey do, na were he con dey make I go meet am. 'We would take you there as the chick dey yarn. Me just enter motor... ******************* As me dey inside motor, dey flex big time. My mind con dey play better track wey the moment need as I dey nod my head ...am boss...Rick Ross_Boss... The journey be like Isrealite's journey because of the hold up, hmmm! The go slow fit make person, buy pure water take use brush teeth, then put motor for reverse, dey waka go work back. I happy as we reach Victoria Island, ee take us 15 minutes drive to Banana Island. The place wey we dey go na Amara Suite. See building, my mouth drop water. ******************* ...As I sight Hon. Osusu Jeremiah Desmond, he just stand shake me, omo boy...I don turn ambassador, my body just dey sweet me like dog wey see him owner. "Its good to see you Big t" Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. My Oga at the Top, your boy loyal oo. "Well, I have gone through your profile and I would appreciate you working for me" Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. *i no get anything to say, as I dey look like JJC* "take this file, inside it contains the information about the nature of the job" Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn.. Na so I take collect am, me look am well well, plenty english full inside,but everything sweet me, na to just be him P.A and that's all. Na so me take sign the file. "Its glad to have you on my side. I got some special benefits for you" Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. Na wetin be dat My Oga at the Top. "Since the moment you singed that contract, your 96 million naira rich, I got you a new three bedroom water front flat plus a boys quater, located in Banana Island. Your new ride would be sent to you on monday" Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. I be dey expect make he tell me April Fool, hmmm! Dat one small, I be one faint, no na wetin I go do na to happy... "This is a file contains everything you need to know"Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. Na where my office con dey. "Don't worry about that your office, it would get to you and I have a flight to catch, perhaps your yoruba love is looking for you right now Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. Na so he waka go, see escorts,money good oo ******************* ....Ijust waka go Irumole place, he get one secret thing wey I want make he do for me. Our talk tey small as I give am money take execute am. Me con go my babe side, she con dey form vex for me. "You did not bother calling me at all, that your going out" Seyi dey yarn. Wetin self, I buy something for you. "What's that". Seyi dey yarn as she dey curious dey look my hand. Na chocolate I buy for you, this one na special one because dem carve your name put...I be one fall for ground as she jump put for my body. ******************* Morning reach, my head dey read meter sake of say na my yoruba love birthday. She just dey act normal, me no even bother to tell her happy birthday. I con go check Baba Ijebu result, my eyes fall out as I no tell any body say my game drop. I go Ojota go collect my money cash 240000 naira. I call Irumole to check my plans, he say tins dey waka well. Na so I go meet my yoruba love back....Baby na clubbing things for you oo, so ready make we commot. ******************* *as evening knack, sun no get mind again, lizard done hide and wall gecko don show face, cricket dey play music, mosquito dey dance, rat dey do vigilante, cockroach dey form wings* .......Na so me wear my confirm cloth, but warri no dey carry last, my yoruba love be like wetin dey use jazz take fine every day. The way she package, I need to put tag for her body, make another man no go snatch her from me. Me con stop taxi wey go carry us go the place, I be Big T so I no need to talk price wit the driver, as he push us reach the place. See levels wen we step enter the Pheelz Bar, the music stop.....Happy Birthday To You...My yoruba love no con know wetin to do as she first give me better kiss based on say na all her friends dey the party. Hahaha me burst smile in warri because I never finish. I signal Irumole for next thing as....na so Chris Daniel come out dash.....'no be you I carry come but na you I go carry come but na you I go carry go sisi agbaribo eya owe' *everybody just dey groove.....the party waka well but Big T head must gum wall like cement for the party. Na eem D.J stop music for me to do my thing, as everybody circle us. Me con yarn dem sam I get one better gift for my babe, na so I tell my babe make she close eyes and face back. Me con wear her one chain wey her name dey dere. As she open eyes look back, she just shock....*kneel down with one leg*...my yoruba love na your face I want to dey wake up see every morning....na you I want make my pikin call mama...na you I wan dey with till I puff...oyibo don plenty...abeg say you go marry me... "What took you so long, yes I will" Seyi dey yarn THE END DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR THE NEXT SEASON "ADVENTURES OF BIG T (THE RETURN) "....as I bend down near the motor, my bullet done finish and na two men I done fall. Me know say I never ready to die...as I still dey think na so two men face me as I hear them cock their gun...me just close eyes like fowl wey survive enter 25th of december maybe ram wey jam Ileya...na so I hear two confirm sound of gun POW! POW!...I see say dem done puff throw wey, but na who con be dat....I just open mouth as I sight 'Small T' wey carry gun..." WATCH OUT
20 May 2015 | 20:36
0 Likes
Yippy!!!!! Na me first sign d last contract ooooo.. @Jclash ur head dey dia... Dis ur yoruba love gbadun u no be small o.. Infact i refuse 2 b jealous *covers face* no worry i go samma u request sharparly onto fb tinz nw nw.. Mah no loose my latest 4rndship
20 May 2015 | 21:11
0 Likes
Very very interest,am expectin more of ur story o
21 May 2015 | 02:53
0 Likes
Viz is kul............. Nice work @Jclash and welldone .............expectinq the next episode as soon as possible.........
21 May 2015 | 03:00
0 Likes
NIce work @jclach you too much
21 May 2015 | 06:36
0 Likes
Hahahaahahha small T ke? Nice story dear
21 May 2015 | 07:09
0 Likes
oyaaa too much money Big T u know say we be padi shey u no go gif me ma own share..... Bin long since i take wedding food abeg invite me wen u wan marry seyi...Owo epo tnz..
21 May 2015 | 09:40
0 Likes
@Sophia woh e pass jealousy o
21 May 2015 | 11:35
0 Likes
Nice entertaining story @jclash!,cant wait 4 d season2
21 May 2015 | 16:20
0 Likes
Great and interesting story.... I thought say you go come gimme that money wey you win for baba ijebu... So your pikin go join your adventure for season two.. Big T / small T Adventure
21 May 2015 | 19:21
0 Likes
Big T
22 May 2015 | 18:49
0 Likes
Nice story
10 Jun 2015 | 18:09
0 Likes
real gobe
17 Jun 2015 | 20:25
0 Likes
walahi... Everytin na dream
17 Jun 2015 | 21:25
0 Likes
big t... Ahbeg wake up from ur fucking dream..... Ufit lie die
18 Jun 2015 | 03:35
0 Likes
nice 1 dude..@walahi... U get mouth dakuest..... Abi u go marry my twin sis make ah dash u free of charge
18 Jun 2015 | 04:04
0 Likes
Eeyah. I day fil una die. Ride on i dey una back lyk hunchback
4 Jul 2015 | 13:57
0 Likes
hope say una dey follow my season two
8 Jul 2015 | 03:39
0 Likes
Hmm i feel ur towi die, na saint dey yarn
22 Jul 2015 | 14:15
0 Likes
Lmao... Dis story na beta Rambo sha. I love d construction of the story mehn. Itz your boy Mr Tpage Flaminton Keep the love alive don't get it twisted
22 Aug 2015 | 22:19
0 Likes
@Jclash say dis story get season 2
10 Oct 2015 | 15:06
0 Likes
Yes the story get season 2 @Jenifa the title na "ADVENTURES OF BIG T *THE RETURN* (by OSUSU TALKS)"
11 Oct 2015 | 08:17
0 Likes
Aiit @jclash
12 Oct 2015 | 03:15
0 Likes
E be like say u n nepa na padi. Anytym u enta house nepa must bring light
18 Oct 2015 | 18:46
0 Likes
Na boss Big T be na
23 Oct 2015 | 04:24
0 Likes
Big T d senior man
6 Nov 2015 | 12:36
0 Likes
Madman uncle T
2 Apr 2016 | 17:15
0 Likes
Where part2? @jclash
13 Apr 2016 | 16:08
0 Likes
Well. BigT moth grease to ur elbow
30 Apr 2016 | 19:26
0 Likes
Nice work @big t.....as U̶̲̥̅̊ b jet li so, I believe say ü® son {small t} ᶃϕ be jacki chan.......na UCDMIC dë¥ yarn
30 May 2016 | 08:43
0 Likes
Nice story
14 Jul 2016 | 17:35
0 Likes
Well done boss
18 Jul 2016 | 15:00
0 Likes
Nice story
20 Jul 2016 | 08:53
0 Likes
Nice tori..... :b
23 Jul 2016 | 11:18
0 Likes
Nic Story Bro
9 Aug 2016 | 21:41
0 Likes
i enjoyed it
9 Aug 2016 | 21:42
0 Likes
short and sweet
9 Aug 2016 | 21:43
0 Likes
Keep It Up
9 Aug 2016 | 21:44
0 Likes
:g
9 Aug 2016 | 21:44
0 Likes
twas a nice story
11 Aug 2016 | 06:20
0 Likes
biig :g to you
11 Aug 2016 | 06:23
0 Likes
read it cool from first to last episode
11 Aug 2016 | 06:26
0 Likes
and I didn't even pause
11 Aug 2016 | 06:29
0 Likes
thanks for making me happy with your story
11 Aug 2016 | 06:31
0 Likes
waiting patiently for your next story
11 Aug 2016 | 06:32
0 Likes
it was a n ice ride all the way
11 Aug 2016 | 06:33
0 Likes
waiting for your next story
11 Aug 2016 | 06:34
0 Likes
till then
11 Aug 2016 | 06:35
0 Likes
:g
11 Aug 2016 | 06:36
0 Likes
se he neva reach to post season 2 ni
24 Aug 2016 | 05:11
0 Likes
@akinduro and @hardeyhollaroye there is season two. Just search for adventures of big t *the return* by osusu talks. Thanks.
8 Sep 2016 | 21:02
0 Likes
@OREVASTAR5 he done ready search for ADVENTURES OF BIG T *the return* (by OSUSU TALKS)
8 Sep 2016 | 21:06
0 Likes
Interesting
16 Sep 2016 | 19:19
0 Likes
Observing
9 Feb 2017 | 18:54
0 Likes
guy dis us tori na konfama i dae follow you like buhari dae follow london nxt episode pls
27 Feb 2017 | 08:46
0 Likes
take am easy abeg oo
15 Apr 2017 | 18:08
0 Likes
Nice one
28 Jul 2017 | 11:51
0 Likes
Hit
28 Jul 2017 | 11:51
0 Likes
Nice one
16 Oct 2017 | 01:36
0 Likes
Nice
28 Dec 2017 | 18:41
0 Likes
Hmm eleyi_gidi_gan ooo
24 May 2018 | 08:12
0 Likes
since 2015 season two Neva dey
26 May 2018 | 06:30
0 Likes
When season 2 go comot
26 May 2018 | 09:37
0 Likes
NICE STORY
8 Sep 2019 | 17:00
0 Likes
i could've read this story if only it wasnt written in PIDGIN!
23 Dec 2021 | 13:08
0 Likes

Report

Please describe about the report short and clearly.

(234) 9121762581
[email protected]

GDPR

When you visit any of our websites, it may store or retrieve information on your browser, mostly in the form of cookies. This information might be about you, your preferences or your device and is mostly used to make the site work as you expect it to. The information does not usually directly identify you, but it can give you a more personalized web experience. Because we respect your right to privacy, you can choose not to allow some types of cookies. Click on the different category headings to find out more and manage your preferences. Please note, that blocking some types of cookies may impact your experience of the site and the services we are able to offer.