ADVENTURES OF BIG T *THE RETURN* (by OSUSU TALKS)
"THE TEASER"
THIS WORK IS WRITTEN BY 'OSUSU TALKS' AND EVERY THING WAS A FABRICATION AND MIND PLAY OF THE WRITER
PLEASE, IF IN ANY WAY YOU WANT TO COPY
THIS WORK OR ANY PART OF IT, KINDLY
CONTACT THE WRITER.
WRITER'S CONTACT: 08147415969;
[email protected]
THANK YOU FOR COMPLYING...
ENJOY THE STORY...
....Me Big T, this kind thing no fit happen to me, at all. Na so I burst come out for where I dey, I check the full area no sign of am. I just run go the end of the area, nothing at all. My mind no gree rest because I must find am today. The only place wey remain for me to check na one police station like dat. Me con shadow, con watch the movement for the station no sign of am but my mind dey tell me say na there I fit see am. I just tear race like Usain Bolt enter the police station, untop dat one still dey shout 'where am! where am!! where am!!!'. Na today my eyes clear, see as police people dey run comot for their own station, everywhere scatter, ee con be like say boko haram drop package for the station. Even people wey con report case too dey run, I con stop to dey run, as I check my body whether I be ghost. Na so the race stop as if everybody dem reach finish line. Wetin con sup na question oo....bros na wetin dey pursue you or wetin you dey pursue... Na so I serious tell them say ee get one girl wey I be dey rape, she con escape, I con run reach her make I ask whether una see am...
********************
Na eem I wake up from sleep with better smile, life is good oo, na better thermocool dey blow my brain. Me just do better check, I notice say my yoruba love no still dey bed, na where she done carry her leg go again. I manage carry my body comot for bed na so I reach palour and she no dey for there, I check everywhere I no she her. Me be one lock up, na so my nose con dey sniff something like old man wey dey sample snuff. Na better be this ooh! My yoruba love dey kitchen dey arrange better food. We talk small, as I browse enter front of plasma wey dem mount put for wall, if thief show face na only remote dey fit move comot. As I dey flex better song 'Shakiti-Bobo by Olamide' for Sound city, my yoruba love con call me say food don reach ground...
***************
We flex the food well, the dinnig resemble all those chinesse own, wey small plate the full their table but this one na different combination dey my front. If no be small tin wey remain I for fat dat moment as I chop finish. As I dey drop spoon na so I notice say yawa don gas, me look my yoruba love, as she take give me sign. Say she understand. Me con lock up, as I sight one person wey open door. Na so I chook hand put under the dinning table, commot my new ochara twin gun. Me no waste time take dash the man two bullet for body. My yoruba love no dey dull, she done push the table fall take do guide, me con watch the room well, na so tear gas roll enter were we dey. "Baby we will make it and am waiting for you at the extracting spot" na so my yoruba love take relate to me, she con top am up with good bye kiss. My head ring bell because of the kiss, na so she cary gun follow one back door.
...My eyes done dey drop water, sake of say the tear gas wey dey the room. As I bang the door open na so two big men burst enter, the next thing wey follow up na better blow, see falling hand this people no know their mate or I look like Bash Ali, the punches be like. Wetin bank dey use take punch hole for fake money. My body don reach ground as I take struggle stand up. Me ready my self like person wey won fight gidigbo. Na so I be like person wey dey que for ATM as them usher me better beating, my body just dey recive free blow as one carry plank knack me, I just fall go back of my confirm chair wey I dey sit down watch football. Me eyes don already dey read statistics as I sight my condo olopa *batting stick*, I hold am well. "Aint you gonna stand up and fight like a man....hahahahaha.... I bet your not even a man" na so one of the men yarn. I just swing my kondo olopa as I catch the one wey just talk finish for mouth, all him just dey fly for air as if we dey party we them spray money, I no stop as me boot am wey he con fall pass window. The second one think say na play wen I panel beat am with the condo olopa.
**************
...My mind come down as I enter lift con dey sing 'have packe my bags, am leaving town, bought one way ticket, I aint coming back *Timi Dakolo Wish me well.....40...41...42...43. As I come out, chia see bad luck, see as people full there, I even think say na normal friends them for we compound, I just hala them...una migwor oh *i kneel down greet una ooh*...na em one carry knife run con stab me, before em chook me, I bend him hand, con still give am upper cut. As all of them con dey shout "haaaaaaa!" As if na "Kunfu Hustle" we dey act. Omo boy see as just dey flaunt stlye as if I train with Jet Lee. Na so one shoot me, before the gun reach me, I just do slow motion bend head as the bullet touch another person, me just give one blow for head as my leg still dey perform Micheal Jackson for two body, as I dey reach groud, na my fist follow, as borrow one for head. Their father, una go suffer, warri! warri!...me just dive one as he shoot me, collect him gun, con still use take dash am for body. As I look back na two dey run come, as I shoot bullet finish. Na so dem smile near me as them won shoot I just tell dem make dem wait first. Abeg I won say my last prayer before I go die but na selfie I go like take ooh. Dem agree as I chook hand for pocket bring my Iphone 6 stand near dem, as dem self con pose. As the light flash na so the phone upload am...before dem remember, I don jam their head together. Pick their gun as I waste them.
**************
I jus climb reach roof go look for my yoruba love, I no dey see her as people dey bang the door wey lead to the roof. As the door burst open, na so I see my yoruba love for helicopter. "Olowo Ori mi di okun yi mu *my husband grab the rope*" Seyi dey yarn. I just run as if I dey do 100 meter race con jump grab the rope, those people wey dey back of door con shoot gun as me con dey shout 'you can not catch me *dose small pikin song*'.
DONT TOUCH DAT DIAL STAY TUNED FOR EPISODE 1