[b][color =red] Laff It Off ontop # SonjiTins[/color][/b] with chief Roes
“Kpregede is a kpregede”
Fowl wen love e pikin dey always dey cover
dem with e feathers, bcos of “ole fowl”.
Na so Baba God take cover me and you come
see this ogbonge nite show paroles.
Make we relate wella, Yan me that thing wen
you miss about your childhood!!!
As for me I miss, wen my melee dey buy ojuku
finger sweet and wen she dey pet me.
Also, I still miss back then wen dem go give
me N5 make I used as offering for church,
then I go put N2, den use the remaining one
buy ice-cream. Also I still miss those time wen
person dey bath for rain ooo.
Abed drop your own make we relate!!! Kpoko
for you