image
Different types of chopping in the government

Different types of chopping in the government

By dencygirl in 19 Feb 2017 | 17:14
share
dencygirl dencygirl

dencygirl dencygirl

Student
Faithful User
Forums Best User
Forum Loyal User
Posts: 3487
Member since: 17 Jan 2017

* When U chop alone in government and no one chop with U, dem dey call that one *OBJ.*_

_* When U chop in government, come allow others to chop their own, that is called *IBB.*_

_* When U chop in government, come bring democracy and people come forget say U chop, that is called *Abdusallam.*_

_* When U chop in government and the place U are choping eventually fold up, that is called *Atiku.*_

_* When U dey chop in government, U no remember your driver, secretary, office assistants, that is called *Gowon.*_

_* When U dey chop alone in government, no remember anybody, so tay dem come drive U comot, that one is called *Shonekan.*_

_* When dem just appoint U for government position, and U just chop small, auditors kon come say bring all papers, that is called *Nwodo.*_

_* When U chop in government and U die while chopping, that is called *Abacha.*_

_* When U chop and drink in government so tey U come intoxicate, and others come dey do U wayo, dey chop their own join, that is called *Goodluck Jonathan.*_

_* When U over-chop in government and U call your friends to come chop their own, that is called *Ibori.*_

_* When U chop and clean mouth like say U no chop anything, that is called *Fashola.*_

_* When U chop in government, come dey abuse people wey give U opportunity to chop, that one is called *El-Rufai.*_

_* When U chop from government, come spread your boys for government, dem dey chop U dey chop, dem dey chop U dey chop, that one is called *Tinubu.*_

_* When U chop in government so teeey U scatter ground, three houses for America, two for London, six for Maitama, seven for V.I, as madam dey go shopping for Dubai, children dey go summer for Spain, EFCC kon gbab U, that one is called *Diezani.*_

_* When U chop well well for government and people know say U chop well well but U dey deny say U chop well well, that one is called Rotimi *Amaechi.*_

_* When U chop in government so tay U come even dey richer than the place U dey chop from, that one is called *Rochas.*_

_* When U chop and chop so tey U come tire, come begin dey distribute the chopping to other people, that one is called *Dasuki.*_

_* When oga U see government money and refuse to chop and refuse to allow make people chop, so tay hunger come dey wire dem, that one is called *Buhari.*_

No be me talk am oo
19 Feb 2017 | 17:14
0 Likes
 
 
faji
19 Feb 2017 | 19:40
0 Likes
Hnmm! Just dey observe...
20 Feb 2017 | 06:10
0 Likes
Lolz Madam Patience Nko???
20 Feb 2017 | 07:16
0 Likes
true
20 Feb 2017 | 08:04
0 Likes
dis one no make sense abeg
20 Feb 2017 | 12:43
0 Likes
Na hu kum talk am.
20 Feb 2017 | 14:13
0 Likes
I go tell Buhari say na you talk this talk when people come dey talk the talk for everywhere...
20 Feb 2017 | 19:04
0 Likes
@denciebabe, u are under arrest
21 Feb 2017 | 01:19
0 Likes
Lol Na you talk am nd I must report you
21 Feb 2017 | 04:08
0 Likes
Lol Na you talk am nd I must report you
21 Feb 2017 | 04:10
0 Likes
Abeg ooo... No report me oooo @victoriouschild @oluwaferanmi.... No arrest me,, na person wey tell two people, the two people come tell person wey come tell another person wey tell me ooo
21 Feb 2017 | 10:54
0 Likes
I no go report you if you go fit give me N5000 mtn
21 Feb 2017 | 11:12
0 Likes
Chiiiiiiisos.... Don't worry, go and report
21 Feb 2017 | 16:23
0 Likes
Is like this bae doesn't know the consequences of her action ooo
22 Feb 2017 | 13:34
0 Likes

Report

Please describe about the report short and clearly.

(234) 9121762581
[email protected]

GDPR

When you visit any of our websites, it may store or retrieve information on your browser, mostly in the form of cookies. This information might be about you, your preferences or your device and is mostly used to make the site work as you expect it to. The information does not usually directly identify you, but it can give you a more personalized web experience. Because we respect your right to privacy, you can choose not to allow some types of cookies. Click on the different category headings to find out more and manage your preferences. Please note, that blocking some types of cookies may impact your experience of the site and the services we are able to offer.