[color =blue]MakeFamilyforBe ta[/color]
[b]coolvalFamily Ko Ko[/b]
wit crew eliboy's team
I DON TELL MY SENIOR
SISTER SAY IF SHE NOR
COMMOT FOR THE
MARRIAGE WEN SHE DEY
SHE GO DIE PUT INSIDE.
My name na Cynthia,
my senior sister don
dey marriage for 3years
now, she don born
2pikin, but the problem
be say after 4months
of the marriage na she
come run come house
say her husband don
change o, Na so so
beating na she dey get
for the man hand,
according to her she
say her husband dey
pick offense for every
small tin wen she they
do and the next tin na
beating ,we as family
we gather Settle the
matter, still the man
nor change he come
come worse pass so
but my sister dey
manage am dey go like
dat.
The one wen happen of
recent, he blow my
sister eye cover becos
he nor quick worn him
food. Now we say
make my sister
commot for the
marriage, but my sister
nor agree instead my
sister dey keep malice
wit us say na we won
break her home.
Abeg my pipo watin we
tell my sister na bad
tin? Also tell us wating
we go do to take make
sure say my sister nor
dey suffer dis kind
beating again. As we
dey shock mouth put to
solution dis matter
make we ask you,
watin you think say dey
make man beat he wife
wen he marry?
.
.
.
.
.
.
As u drop ur coment dont 4gt to vote @eliboy
team :
@macrex
@hauwa
@yusingkey
@adura
@j-sharp
@inetfunmiyahoo-com
@victoriouschild