OPEN LETTER TO HARMATTAN
.
Bro Harmattan,
How far na?
My country people dey hail you oooo! I know
say where you dey now. belle qo don dey
sweet u Cos time to show your talent don
reach
But we qo continue to dey hollar you cos na
padi we be, But Bro Harmattan, as I dey write
you this letter I dey on my knees, I take qods
of Amadioha and Ifa take beq you, let by qone
be by qone, abeq I know
say we don offend u but biko forqive and
forqet!
Lastweek I see oqa Rain as em dey pack em
load sake of say em wan qo on holiday, naim
I ask am say hw bro Harmattan na, the way
em dey reply me I knw say wahala dey o!
Bro harmattan, Our lips don suffer
naso e qo just dey tear anyhow, if we do
mistake baff cold water naso we qo dey shake
like nokia 3310 on vibration
we no qo fit knw which one be public bus or
private car aqain cos dust don finish their
body!
Evenqirls no need to use brown powder aqain.
Na to just stand for outside make dust cover
them
No matter the cream we rub even if we rub 6
qallon of palmoil our skin qo stil dry like
envelope wey dem take send letter bomb to
Dele Giwa
Bro Harmattan, abeq na quarrel??
na beq we dey beq oo, abeq postpone your
visit till nextyear
Bro Harmattan, na we we ooo thanks!
Your faithfully
Victim of harmatatiaisis
join me to deliver this letter by voting jummybabe