[b]dem say Lassa fever don dey garri after i buy half bag for house, i com say make i test am if na true.
I soak garri put milk inside cum give my dog Bingo, make im first test am.
45 mins later, bingo still dey waka, dey jolly like say nothing dey happen, na! I drink my own, after i don drink am finish.
My gateman just run come
*faaaa*
com tell me say bingo don die,
Ewoo! I run enta house, begin drink full gallon of palm oil for my belle, chop 22 bitter kola with 3 long bitter leaf stem, chop walnuts with the shell, *no time to crack* swallow moringa with aloe vera as treatment combo, garlic and onions be like sweet for my mouth, i cum dey sweat like christmas goat.
*omoh! No be small tin o*
i dey think say my life don finish, i cum outside, na my gateman kon dey tell me say d driver wey kill bingo wan com beg me!
If na u wetin u go do d gateman.
Dont laugh alone![/b]