image
I Shall not Die! by Foxybone

I Shall not Die! by Foxybone

By Cool in 3 Jan 2014 | 13:01
share
Cool Val

Cool Val

Staff
Faithful User
Forums Best User
Forum Loyal User
Loyal Writer
Posts: 3735
Member since: 17 Jun 2013
E don tay wey me I write story
with pidgin English so as I see
say the trend wan come back, I
say make I com yan una this very
short story... Una comment and
criticism dey highly welcome as
the journey dey begin
immediately..***
****************************
*******************
As e dey be say I dey always stay
with my senior sister na, I no dey
get chance to do wetin I want.
Sometimes self, na she go dey
ask me questions like:
"Attai, why no girl dey come look
for you?"
E dey surprise me o but I no send
because I know say I bad pass as
she dey carry think am. For our
compound eh, na 5 flats dey and
we get one neighbour,
Nassarawa man wey get two fine
daughters. Me and my younger
brothers dey plan fuucckk those
chicks wella but e be like say the
world no just allow us fucxk
them. We don chike, don dance,
don smooch but before any
serious thing go begin in the
night their silly father go just
carry imself come back house.
E dey pain for body to see how
the otekwus with their bakassi
penisula dey carry run enter
inside house come go pretend
say them don sleep since. The
father ma go come dey look me
and my brother for face. I no
even know wetin the man dey
fear for our head self.
Na so one morning, I pretend say
I dey sick, I no wan go work. I
comot go well go fetch water
come back. As I dey come, I see
say this man don baff finish,
dress make him begin go work
but as he see me, he just do U-
turn go back inside. I believe say
him dey wonder wetin I dey do
for house at that time. Normally, I
dey always leave house before
5:00am in the morning.
I enter inside finish, come go
climb bed, my sister don comot
go work, her husband don go im
office, even the children don go
school. My junior brother wey
dey barb hair for Maitama don
waka comot ma. I just siddon
dey reason how I go take chuke
one of the girls when their papa
comot.
"Hasiya, zo ki je ki siya mun
magani"
*Hasiya, come go buy me
medicine*
Chineke, the man ma don dey
sick. Which kind man be this self
wey no go allow me chop toto
wey dem don dey offer to me
freely since. I vex eh, na so I
come outside come waka go well
side go siddon dey think. I don
lose N1,500 which na salary for
one day. The surcharge issue ma
come pain me wella.
I dey make I go baff******
3 Jan 2014 | 13:01
0 Likes
 
 
I was still brooding over the money that would be deducted from my salary when I heard footsteps. I turned to see the angry face of the nassarawa man looking at me. I swallowed hard and smiled weakly before using the weakest voice I could muster to tell him "gooooddd morrnniiinnggg" I surprised myself too because I sounded sick. The man looked at me, angrily and twisted his mouth to one side like he was considering what to do to me before turning abruptly and walking back into his flat. Chei, that one close o. I no know when I carry my two legs run enter inside house. Na there I just siddon dey think over the whole matter. This man no go give me space make I do wetin I wan do and now that silly Mr. Ojo go still cut my salary. "Attaaiiiii..." I heard a feminine whisper. I jumped and went to the window to meet Zainab smiling sheepishly. "I hear say you no well" She said before breaking into a silent laughter. I surprise eh, how come this girl dey laugh when she know say her father dey house. Na the same girl wey no dey fit comot when the father stand outside compound self. "How that one carry concern you?" I asked nonchalantly. She just looked at me like I just pierced her heart with something sharp as her face became clouded immediately. See me see wahala o, rain wan fall from her face ni? "So I can't care for you ba?" She asked in the normal Naija fashion. Na wa o. "If you wan care for me, you suppose carry breakfast come." I said before turning round, leaving her standing there with her mouth open. I went back and sat down, brought out my phone and logged into Nairaland. I tried opening a topic only to see that I had been banned for trolling. Na wa o. Wetin self come be troll. I just shrug, open my system, connect my modem come start the procedure of opening another moniker. E no easy o to dey remember all the passwords sha but I dey try. "Owk, wetin you go chop?" I heard from behind me. Ogene mo si bua (who go translate am? hope I no swear for myself). Na so my heart perform acrobatic sharpaly. So this babe wan defy her papa come please me? Make I kuku ask am see. "zainab, what of your papa na?" "He has gone to his business place." So finally the man comot. E be like say him don begin trust me o.... Make I go buy garri abeg****
3 Jan 2014 | 13:04
0 Likes
Sometimes eh, if you sabi english wella, or you dey like me wey come begin write for literature section where be say some people go criticize your writing once your grammar bad, you go understand how e be like to write with pidgin. Na small thing remain self make I forget how to type and speak pidgin. ******************** "So your dad been no wan comot because of me ba? Him forget say no be salary them dey pay am and him go lose more money that me?" I ask JAMB question. Before the babe answer, I come give am options for my mind. "A. Him foolish (b) Him head dey touch (c) I go still straff you tire (d)if you get belle, I go waka, run, fly and disappear. "I believe he would be back soon." Na so she carry queen's english take answer me. Well, me I no care, in fact, all yellow boys no dey too care. Na those days we dey play love. This days, na wetin we fit gain make us dey follow woman. Seriously, I don reach the stage wey be say I no dey toast again, I go just look babe, wink her, lick lips and she go follow me enter room. I trust that baba na (that na story for another day). "Well, I hope we get to gist well before him come back na" I code mixed my English. She just smile shyly just comot from inside our sitting room. Na so I jump up gallantly like cat come tip toe follow am for back dey admire the nyash. I no even know when she stop, na so I bump enter her come carry my hand roll on the waist carry my dii"ck press hard for the nyash. Choi, the thing soft. "Attai... Attai... Let me go and cook for you na" She said as she struggled feebly in my grip. "For where, you carry food wey don done wan go put for fire again?" I asked referring to her Kitty-Cat that I would demolish soon. Na so my hand still maintain him grip for her waist o. "I mean the indomie, it is inside the kitchen." She said as she struggled while I freed her. She turned, look me in the face and smiled shyly before exiting our flat for theirs. Choi, that big nyash wey I don dey admire, I don finally press am with my preek. Men, why be say nyash self dey high me like this self? Okay, una need to read my story... "Tales of an Introver".. Make una understand well. I sat down and began praying, fasting and hoping in my mind. I no know when I open my mouth begin declare: "I shall not die but will live to fuucck this pus's'y before me." Na so I dey shout am until I hear voice from outside. "Attai, which pus's'y?" Na Zainab get the voice ooo.... "Na pu's'sycat wey I see for dream oooo" I shouted back and continued, my hands holding my chin with my eyes rolled inside as I imagined how her body would look like Unclad. Even the N1,000 surcharge self no come dey pain me like before. I know say e go pain sha when month end but by then I go don straff Zainab to even worry. After all, sacrifice na normal thing if you wan receive. I dey come abeg... My dick eh***********
3 Jan 2014 | 13:08
0 Likes
E get how you go take reason babe toto well, you no go even know when your hand reach your preek begin touch am. Na wetin oyibo dey call ma's'turbation and we for Nairaland dey call am "wanking". Na so I dey play with my obolojombo reach the head come concentrate say I dey fuc''k zainab hard and fast. Na so the sensation dey wash all over my body until I hear giggle for my back. I freeze, quickly jump up come turn back, I don tuck my 'di'ck back inside my trouser. Na so I stand face2face with Hasiya. Una know how e mean to be caught red handed na? Na wetin just happen to me. Choio, I no believe say person go catch me during my personal moment. My dic'k' just hard against the trouser wey I wear and as no be jeans self, e no even help matter. Hasiya just dey look me for down dey giggle. "Ehm, no be wetin you think" I think say she go don carry shame run comot since na she dey form virgin self between she and her sister but for where. The babe just dey dia, to move her eyes self na war. "You preek big oo" (Angel, you don hear? See babe dey confirm my preek) Na so her mouth hang open. Trust me na, I no even make move to hide am self. Na so I leave the thing as e no gree go down. Instead e just dey nod head to the compliment wey dem just pay am. "Na normal thing." I answer her. I dey look am to see if she go turn back but for where, her next question 'swept me off my feet' like Neyo. "can I see it, please?" Whatttt.... Alarm begin ring for my head. Hope say them no send this babe come. "Yes you can." I swear no be me talk, na the useless preek open im mouth yan that one. My mouth no even move self but the voice sound like my own. "But not now" I believe say na my mouth talk that one. "Owk, can I at least touch it?" She come ask. Chei, why she wan touch am, e no go tay she go ask whether make she suck am. Scrap that one, na my prayer make she offer to suck am o. I no go even mind at all at all. "Be quick about am" Before I complete the statement, she don rush me, carry her hand grab my joystick from outside my trouser. Wallahi, the feeling eh fit light 1 million bulb. Na so I suck my air enter back into pipe come carry my hand grab her brea's't. Na so she use her shoulder comot my hand from her bosom but her hand still dey my preek She just hold am. Na wa o, the babe fit be virgin but I nearly change my mind as I look her face see say her eyes dey close. Na so she squeeze my dick hard but softly. "Ushhhhhhhh" I no even know when the sound escape my mouth, but who cares, na virgin dey make me moan so. "Hasiya!!! Where the plate?" Na so I hear Zainab voice for outside. I quickly turn, her hand still hold my preek but I quick brush am throway. I jump climb chair come carry pillow cover that part. Door open, Zainab waka come inside, Hasiya still stand like no-man's business. Zainab waka pass her enter kitchen, grab one plate come outside. "Come help me fry the egg" Zainab say as she drag Hasiya dey go outside. Chineke, me eziokwu. This thing no look funny again o but even though them cut half of my salary, if I fit fuucck both sisters, e go so make sense eh. I just smile dey wait for my indomie. BRB... Sorry, I think say na 2go be this....
3 Jan 2014 | 13:22
0 Likes
"Let me feed you na" Zainab insisted on feeding me even though I had tried my best to evade the fork from getting into my mouth. "Where your sister?" I asked her. "She is angry o, she is lying down inside the house" I no surprise at all. Who no go vex when person come spoil him moment of enjoyment? Me even dey vex wella, I remember when I been wan straff my friend "sister" one time like that (I post the link) and my friend just come inside, thank God say him been don announce him presence from outside. Na so I quickly zip up o but kai, I no fit rest. Me and the babe comot go complete the fu'cking for inside one uncompleted building. That na story for another day. "Haba, hope say you no shout for her head" I ask am as I finally agree to collect food from her hand. Na so she smile shyly. Wetin be the babe own and this shyness self? "No o. I was only angry she did not bring the plate back immediately I sent her" Owk na, I don hear. Na so I concentrate dey eat while she ma dey eat from the same plate. Me and her siddon for the same side dey face each other. My belle self don dey full so na so I carry one kind thought for my mind. As she feed me one spoon, na so I hold some of the indomie for outside come lean come her side carry my mouth go her own. I dey expect make she reject am but for where. Na so she extend her mouth just collect the indomie from my mouth. Our lips just join for some seconds. Na so spark like disco light just dey spark around us. That Pumba and Timon song for "The Lion King" come dey play for my head. #Can't you feel The love tonight... It's in the evening breeze# Chei, I been wan collect her lips for my own but I just maintain. Anything wey make me no go work no go make me hurry. Na so I chillax as she move her face go back come face down dey smile shyly. Lobatan... My dick just nod im head slightly. Na so I press am down tell am make him relax first. "Do you really wanna kiss me?" Na so she throw me NASA question. Kai, I begin wonder when I begin work for National Space Agency. "I no wan kiss you, I wan use my tongue count your teeth" I no tell am that one o, na my mind I talk that one. "There is something on your lips" I use one kind husky voice. In fact, no be my voice, na my diicckk own. Before she go ask me wetin e be, I don lean forward drop kiss for her lips, e dey more like peck. Na so I say make I withdraw back but for where, the babe don open her mouth hold my lips begin kiss am. I dey come abeg, piss dey catch me!!
3 Jan 2014 | 13:41
0 Likes
I was looking at the babe because my eyes no gree close. I just dey wonder wetin enter the babe head. I no even know when my hand grab the bosom. "Uhhh" I pause, wetin make this babe dey make that kind sound. I never even start anything. Choi... To be cöntinued.
3 Jan 2014 | 13:45
0 Likes

Report

Please describe about the report short and clearly.

(234) 9121762581
[email protected]

GDPR

When you visit any of our websites, it may store or retrieve information on your browser, mostly in the form of cookies. This information might be about you, your preferences or your device and is mostly used to make the site work as you expect it to. The information does not usually directly identify you, but it can give you a more personalized web experience. Because we respect your right to privacy, you can choose not to allow some types of cookies. Click on the different category headings to find out more and manage your preferences. Please note, that blocking some types of cookies may impact your experience of the site and the services we are able to offer.