image
Let's kill boredom together¿..

Let's kill boredom together¿..

By BOB in 20 Apr 2020 | 18:54
share
BOB SELLA

BOB SELLA

Student
Faithful User
Forums Best User
Forum Loyal User
Posts: 358
Member since: 4 Jun 2019
Let's kill boredom together for this lockdown,let's pretend to be inthe same house for this lockdown,oya let the argue begin,
@ladyg hope say no be you took my charger or na @fb-danieledem and again i don't trust @henrymary
oya answer me ooo.......
20 Apr 2020 | 18:54
0 Likes
 
 
Hmmm @harzaroboy charger kwa? Abeg o, u sure say no b d charger wey i see @kelly-kelvin dey use so? @fb-danieledem nd @emreks, their own is 2 eat all day.
20 Apr 2020 | 19:31
0 Likes
Emm @harzaroboy check @itzprince room or ask @hormortiyor u fit even ask @fb-olamideayomide may be them see am as for me i knw even no the colour of ur charger
21 Apr 2020 | 01:18
0 Likes
@harzaroboy na desktop i see
21 Apr 2020 | 01:57
0 Likes
@harzaroboy ask @hormortiyor am sure he knows where it is. @maths I dey look you one eye o
21 Apr 2020 | 03:23
0 Likes
But wait o @harzaroboy hope say no be because of that my new original charger you come dey ask for your own?
21 Apr 2020 | 03:25
0 Likes
(Rushes out from my room after hearing my name been mentioned) @harzaroboy,shey na everyday you dey find something ni? Since Coro don pakus all of us for inside house na so so find find you dey do. But wait, @Ladyg! come here. Wey the charger wey @fb-danieledem borrow you? E fit be the charger.
21 Apr 2020 | 03:44
0 Likes
@maths, you no go know the colour of charger na when dem don bribe you with food. @itzprince, which dey you buy new original charger for inside this house wey we no con know. I dey smell foul play.
21 Apr 2020 | 03:48
0 Likes
Bia @hormortiyor u see me 4 dream or wetin sef? Persi no fit rest for dis house ni, na so ur mouth go dey talk since dis coro keep persi 4 house, abeg do start work make i hear smtin biko bt wait o, u don ask @maths, i no trust dat guy.
21 Apr 2020 | 04:15
0 Likes
Ehn! Ehn! As i no wan talk since now ina no like am everybody just dey mention my name. @ladyg na me u no go fit raise voice for why u no go meet @emykas or @henrymary. Infact i de suspect @fb-danieledem bcos d guy no gree talk since. @hormortiyor mind urself for this house oh.
21 Apr 2020 | 04:36
0 Likes
infact @harzaroboy way get Charger self i no trust am, ina sure say em neva sell am take chop akara.
21 Apr 2020 | 04:40
0 Likes
@ladyg, nobody dey talk dream here. Reality go soon hit you now. But wait oow. @maths,wetin you talk fit be true oow. @harzaroboy wey sell him back pack go chop Puff-puff when corona no dey sef. Shey @oneal32 no dey this house ni?
21 Apr 2020 | 06:21
0 Likes
Na because of charge una dey disturb yard like this
21 Apr 2020 | 06:27
0 Likes
Kikikikikikiki i dey laf all of una 4 Chinese language cos already my visa don ready 2 go China bcos wahala don too much 4 ds house, if e no b @hormortiyor, @maths or @harzaroboy, go dey cal me as if say wetin happen sef.
21 Apr 2020 | 08:13
0 Likes
My bros @Bling na charger dey cause all ds wahala o, abeg help me beg dem make dey no cal my name again o. Dis 2 guys @emreks nd @fb-danieledem hmmm, mayb na their 2 hold dat charger o .
21 Apr 2020 | 08:25
0 Likes
This one wey all of unna dey talk no concern me o... @ladyg na who take the hollandia yoghurt wey I put inside freezer???
21 Apr 2020 | 08:48
0 Likes
(washes hand after eating and comes out) @LadyG i don chop finish you say you dey find sanitizer?
21 Apr 2020 | 09:10
0 Likes
(holding holandia yogurt and sipping it) una just dey disturb me and @fb-danieledem, ah ah... @Maths come join me drink yogurt ooo...
21 Apr 2020 | 09:14
0 Likes
@ladyg i av been sleeping afta our....... @maths @henrymary are seriously disturbing my sweet rest
21 Apr 2020 | 11:01
0 Likes
@fb-danieledem why you no go talk like that when you and @emmyteks don finish my hollandia yoghurt... I'm going to give both of you the chance to provide another one for me ELSE,HELL GO BREAK LOOSE for this house and as for you @maths if you like yourself no join them drink am o
21 Apr 2020 | 13:19
0 Likes
@emreks ur own better naa, see ur big belle. @fb-danieledem order food online at Kilomanjaro abeg am tired. @kelly-kelvin okay o with dat babe ? No wonder.
21 Apr 2020 | 13:33
0 Likes
Wow! Wow! Wow! I don get alart Godiwin x2 (dancing). @oneal32 @itzprince @fb-danieledem @emreks @hormortiyor @henrymary @ladyg @kelvin-kelvin @haykay maga don pay ooo. @harzaroboy how much be your charger at your phone money join i go give u. Infact i dey pack comot for this house i won go banana island.
21 Apr 2020 | 17:02
0 Likes
Ore mi ti high @maths
21 Apr 2020 | 18:00
0 Likes
@fb-akintundeoluwatobiloba-ayomikun, guy abeg try change dat name biko, is over long o nd beside i no dey take yogurt o.
21 Apr 2020 | 18:01
0 Likes
@maths my charger is $5,000 and beside shey na you take am before....
21 Apr 2020 | 18:45
0 Likes
@fb-danieledem,abeg when food ready, call me. I wan sleep small
22 Apr 2020 | 04:07
0 Likes
@harzaroboy bcos i wan help ur life nw u wan dey accuse me.
22 Apr 2020 | 10:23
0 Likes
Infact i go report all of una @coolval
22 Apr 2020 | 10:24
0 Likes
@fb-danieledem @maths @ladyg @henrymary @emmyteks @homortiyor all of you na come carry your dinner after that i go tell you another matter arising....
22 Apr 2020 | 15:19
0 Likes
@harzaroboy thanks so much i ve already taken my dinner, bt whice matter dey arise kwa?
22 Apr 2020 | 15:40
0 Likes
Or this time around na ur two balls u go beginning dey look for, abeg ask ur babe o, na she go kn better o @harzaroboy.
22 Apr 2020 | 16:45
0 Likes
@lady u no go kill me with laugh, @harzaroboy hope no be say any of ur thing lost again o. As for dinner me and @emreks don go chop for emm babe place.
23 Apr 2020 | 17:48
0 Likes
I see one babe her name na @chimmy @itzprince how u see her.
23 Apr 2020 | 17:49
0 Likes
Someone cannot av peace of mind in dis house abi
24 Apr 2020 | 08:47
0 Likes
@chimmy left us since to se a brother nd nw al borders re close
24 Apr 2020 | 09:44
0 Likes
Who is fasting again in this house cuz am fasting and @ladyg go and wear something make you no spoil my .......
24 Apr 2020 | 10:05
0 Likes
??‍♂️??‍♂️??‍♂️
25 Apr 2020 | 17:56
0 Likes

Report

Please describe about the report short and clearly.

(234) 9121762581
[email protected]

GDPR

When you visit any of our websites, it may store or retrieve information on your browser, mostly in the form of cookies. This information might be about you, your preferences or your device and is mostly used to make the site work as you expect it to. The information does not usually directly identify you, but it can give you a more personalized web experience. Because we respect your right to privacy, you can choose not to allow some types of cookies. Click on the different category headings to find out more and manage your preferences. Please note, that blocking some types of cookies may impact your experience of the site and the services we are able to offer.