episode8
Me-ok i dey follow you,but where we dey go sef
Andrew-calm down i wan give you send off
(after walking for 25mins)
Me-i hope say no be dat ashawo house we dey go
Andrew-yes na,don't worry shey na moni dey pain you,i go pay for you
Me-you dey mad,shebi you say you wan do send off for me
Andrew-yes na,na the send off be this
Me-(laughing)guy you no well,so if your papa wan do send off for you im go carry go ashawo house
Andrew-ok where you wan go
Me-make we go dat bar wey dey dat side we fit see girl toast
Andrew-no p but na you go pay for your self
Me-shey i tell you say i broke ni
Andrew-oya make we dey go
(entering the bar)
Me-omo see all those girls wey dey dat table,make we go sit down for their table na
Andrew-omo na true o,dis girls set o make we dey go but na you go talk o.
(going to their table)
Me-(make dis girls no go disgrace me sha) hi girls
Altogether-hi
Me-are this 2 sit taken cos me and my friend would like to sit here
Altogether-you both can have your sit the two chairs are free
TBC