Episode 36
continues from last episode
It's been quite a while now. Jamb has come and gone. University life or should I say campus life is much more than what I expected in every regard. Good or bad? Well I won't say bad like BAD but it's still not great like GREAT either. But one sweet side to it is my dream job is seeming attainable. When my parents died, it seemed like all hope was lost, but now thanks to the way things turned out, I can smile again. Well, today is Tuesday, I'm in 100 level and I have class today by 12. Time's 8:36am.
Make I describe where I dey stay self, Abii una don forget say university dey different from my side? This is the city, and I'm in uniben, but I live not inside campus, neither close to campus. Not too far off either. I have a car, so it's not that big of a deal. I stay in a room and parlor self contain, as per my request. The king wanted me to stay in a flat, like his daughters, but I decided to keep it small. After all, how many of us want stay inside how many rooms?
So life has been okay, school has been okay so far. Although getting here wasn't easy, the exams I had to write, abeg make I nor even talk about am self. So made new friends, male, female. Trying to minimize my friendship with the princesses, both of them. Because the kind vibe wey I Don dey get from them since Ehn especially ovie, one day na sweet friend, the next day, she don turn witch. Me taya nor be small. Well, when I say minimize friendship, I don't mean me not talking to them, but I try as much as possible to reduce or if possible self not go out to anywhere with them, make dem for nor get the idea say na relationship Abii na strafing na I want. Dat kind tin for sweet sha o, but haba, I get conscience na. Their dad practically made me his son. Gratitude is my one and only strong suite.
-------------------------------------------------------------
Back to the present.
I made my way to a nearby restaurant around 9am. I've been reading since I woke up, yeah, I dey enjoy to read o. See una head, nor just call me book worm o. U nor even ask wetin I dey read. Romantic novels jare.?? sometimes it even distracts me from actually studying, but I get Brain, na dey save me. Unlike some people for school wey i know. Make I nor mention name jare. So I entered my car and drove off. Over the course of months, I've increased in built considerably, shoulders broad, chest shows through almost every shirt. And I've grown a beard too, not a moustache o, a beard, or bear bear.
I got to a local restaurant, famished. Yeah I mean local, I prefer the local mama put joint to those high class hotels. But the problem wey i always dey get for this mama Uzo joint na say poto poto always dey her front of shop. So I always park a little bit far off and walk down. I don't like getting my baby dirty. I entered and ordered for some food. Better swallow. After I ate, I got back into my car and was about going back to my apartment when a call came in. Phil. Yeah, I didn't bring you up to speed as to what has been happening with Phil. His dream of owning a computer shop is realized, and he not only owns a computer shop, he has a warehouse, only he stays in port Harcourt now. He heard life there is more eventful than it is here. I agree sha, Benin na dead zone.
**call mode**
Phil- "my guy, Afa na, how ur side? "
Me- "badoo, I just dey oo. How e be na? Me just dey come out from one joint like that. I go wage conscience. Where u dey na?"
Phil- "As e be like this so, me dey Benin o, e don still tey. I just enter town so. Where u dey na?"
Me- "u don't mean it. I dey Na, just tell me where u want make we see, u know say I nor dey jonx na"
We arranged a meeting place and he hung up. We agreed it would have to be later, cause of my classes in the afternoon. If not for small tin I for just leave that thing go see my guy but that Mr. Benedict wey be our lecturer nor just like me at all. I am trying by all means to avoid his trap, and believe me he has been setting trap upon trap all around for me. I serve a living God ??.
I sped straight home, well not straight exactly. I stopped by my dry cleaner shop to get my package from him and then went home. Either Abies or ovie is yet to call me, well I'll call later sha, if dey don't. For some reason known only to them they don't live together. Separate two bedroom flats. Guess since they are girls they need their space especially if they're both expecting company, male company. *winks* ..
Well the rest of the day was uneventful, attended lectures, saw them princesses in school. Gist small, even went to Abies apartment to get somet6, just to get something o. Nothing happened. She even has a guy self. One short fat guy like that, lol. Wetin concern me self, as far as she happy. She always says that she likes the guy, and all that. But no formal introduction yet to the king. Later in the day I went to see my guy, precisely around 7pm. We met up at a bar and mehn this guy Don fat. I nor say grab oo, I meant fat. We hugged and shaked hands and laughed . I yabb am sha.
** me: "philo one, see ur belle. U sure say one of ur babes nor give u belle so? Fatty bobo "
Phil: "Ehn leave am. U nor know say na sign of enjoyment? My guy I nor get stress. I go soon marry self, u think say na the way I be b4 na I be now? I don get sense oo, I don wise up".
Me: "Ehn if u want marry, I happy for you oo. So u want marry na u nor tell me since, congrats jare. So I know her? describe her for me. She fair,she black?"
Phil: "ogbeni calm down, see as ur eye dey shine. Dey ask me question like woman, village gossiper"
Me: "Ehn I like am, tell me jare"
Phil: "how I want tell you wetin me nor know self, I tell you say I don see who I want marry? U just dey ask me question like FBI agent"
Me: " ewoo dis boy, ur life npr just get direction. Nor be u just tell me now now say u want marry so? "
Phil: "chil, just listen. I'm in a tantalizing situation. I have two girlfriends, I meant three.....
Me: hahah......
Phil: "guy just shut up first haba, before u start dey call me male prostitute. Nor be my fault, na only one na I actually toast, the remaining two one thing lead to another and we become fuck mates, for my own side sha. All of them like me and me self I like all of them, I don come to like them. So of all the girls wey I Don straff for the past 6 months or so, na only this three na me want choose from because me like the three of them and dem go be better wife material. I'm conflicted my guy "
Me: "lol, so, na three na u get now, or wait dem even pass three self, lol, this boy u nor go kill me with laff oo. Why u nor fit be like me self, u be like street fowl, fuck fuck fuck fuck, Hehehe....
Phil: "Shey u don talk finish? "
Me: "no oo, so none of dem Don get belle, I wish na so e be e for easy to choose na. Maybe I wish na even two self, u for just get the two for house. U get money na, u for fit take care of them. If na even the three self, ur thinking Don stop"
Phil: ""oloshi, three na go kill u there. Ur three wives go born triplets each, mumu"
Me: "if u like, talk, na better thing na I dey tell u so. Oya because of God o, make I help u. Which of them u like for specs, asin which one be ur main specs?.....
..........
To be continued
Guys this is the official come back of my King's daughter. I know it's been long, but I hope to get some reads here at least so I'll know I should continue and some comments too, please. @frankkay please call the register oo, so they'll know this is back