image
Naija For Life.

Naija For Life.

By Khola46 in 26 Jan 2016 | 11:09
share
Khola46 Khola46

Khola46 Khola46

Student
Faithful User
Forums Best User
Forum Loyal User
Posts: 3389
Member since: 6 Jan 2015
NAIJA SHA...
.
.
1. Nah only for Naija you fit win aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card.

2. Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship....

3. Nah only Naija you fit see fish inside "MEATPIE"....

4. Nah only for Niaja PHCN dey say win a band new GENERATOR if you pay your bill(what a pity"...

5. Nah only for Naija you go see people dey horn for traffic light so it will quicky change from Red to Green...

6. Nah only Naija wey you go see Pharmarcy dey sell Coke, Recharge card, Chin Chin, Puff Puff and Beer...

7. Nah for Naija you go find a graduate of MECHANICAL ENGINEERING dey do him NYSC for police station....

8. Nah only for Naija you go see one person deh use Bold5, X2, Ipad2 and Nokia N8 all at once...

9. Nah only for Naija you go see a graduate of LAW dey work as generator repairer...

10. Nah for Naia you go buy Coke, them go say make you no forget to return the bottle...

11. Nah for Naija you go see madman dey control traffic, people wey their head correct go obey...

12. Nah for only Naija you go see advert from native doctor on how to make quick money...

13. Nah only for Naija you go wish somebody "happy birthday". he go answer "same to you"...

14. Nah only for Naija you go see a sign board with "Buy your Recharge card"-(shey nah my recharge card ah go still pay money to buy?)...

15. Nah for Naija you go ask person "where you dey go?" and you'll get a reply like "I dey come"...while you still dey go...

Wetin you no see for Naija, you no fit see ahm anywhere in the world...
.......NAIJA FOR LIFE......
26 Jan 2016 | 11:09
0 Likes
 
 
Proudly Nigeria First 2 comment
26 Jan 2016 | 11:18
0 Likes
we still remain the best... Na only for 9ja you go see mad man dey play Baba ijebu and wesco lotto lol .
26 Jan 2016 | 11:33
0 Likes
Chai 9ja is the best jare :)
26 Jan 2016 | 11:39
0 Likes
Lolx .... What will i nt see in naija
26 Jan 2016 | 11:43
0 Likes
Abi o
26 Jan 2016 | 11:58
0 Likes
Asin I Dey Tellz U......9ja 4 Life
26 Jan 2016 | 11:58
0 Likes
9ja no dey carry last na.... new here plss,,, nyds fwends around
26 Jan 2016 | 15:06
0 Likes
naija a great country
25 Apr 2016 | 06:26
0 Likes

Report

Please describe about the report short and clearly.

(234) 9121762581
[email protected]

GDPR

When you visit any of our websites, it may store or retrieve information on your browser, mostly in the form of cookies. This information might be about you, your preferences or your device and is mostly used to make the site work as you expect it to. The information does not usually directly identify you, but it can give you a more personalized web experience. Because we respect your right to privacy, you can choose not to allow some types of cookies. Click on the different category headings to find out more and manage your preferences. Please note, that blocking some types of cookies may impact your experience of the site and the services we are able to offer.