My Android don chop my money tire, na him I
come vex yesterday sell am, come take some
money buy chinaphone! The phone get TV,
Touch screen, Nail cutter, Fire lighter etc. I fit
write Text message with toothpicks sef. But now
am in bigger trouble!!!
1. E go full after 3 minutes of charging.
2. The spellings get mistakes e.g NokLa,
blackderry, i-pon, samswag etc.
3. When aeroplane pass, e go record "One
missed Call".
4. When a big car horn; e go show "Charger
connected"
5. When Chinese man pass, e go show: "One
Bluetooth device found"
6. When fine lady waka pass, e go show "WiFi
On"
7. When ugly lady waka pass, e go show, "Virus
detected"
Abeg ooo! I wan sell am! Who wan buy ooo?
Even as I dey find buyer, e dey show me for
screen say "No contacts found"
Pls don't laugh alone, send to those you wish to
put a smile on their face.