image
Pidgin Proverbs

Pidgin Proverbs

By Adedayo in 9 Sep 2015 | 12:32
share
Adedayo (Kingson1)

Adedayo (Kingson1)

Student
Faithful User
Forums Best User
Forum Loyal User
Posts: 1359
Member since: 17 Jul 2015
1. Na for old age ashawo dey
know the value of
pikin.
2. Woman wey never see
problem... Na im dey still
hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no
dey wear pant
sleep.
4. Rat wey follow lizard enter
rain, Na later é go
hear am.
5. Na for afternoon dem dey find
black goat.
6. Weather hot!! É No mean say
fowl go lay boiled
egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back
cross water, wey say
him march fish, wetin him mama
go march?
9. Small pikin wey dem carry for
back no know say
the journey far.
10. Person wey don faint before
no be stranger to
death.
11. Person wey chop belle full,
no know wetin
hungry man dey see.
12. No be as woman dey close
eye enjoy sex she
dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey
cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko
tree, if nobody hail
am!! é go hail himself
15. Toto water small, but é reach
prick take baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO
BOYFRIEND, SHE
GO TAKE BOYFRIEND DO
HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam
bad luck.
18. Na cricket tell him children
say, No matter how
ground strong, Them no go
sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no
fine they use style
call him papa blind man.
20. No be eye wey dem take
chop eba dem take
dey share meat.
21. Person wey use Elephant set
trap, na him know
wetin he wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash
Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM
SERIOUS, BUT
STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW
BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say
race don start.
25. Dem no dey tell blind man
say salt no dey for
food.
26. Before you see monkey,
monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter
house where owner
dey wait for am, no go jump
again.
28. If pikin say he sabi die, him
papa sef go tell am
say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat
mouth, Na im dey
kill am.
30. If e be like say everybody dey
craze" na you
dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no
use your teeth cut
am.
32. My thing and our thing no be
the same oh.
33. Na happiness dey make prick
stand.
34. Na as goat stand for market
dem dey price am.
35. Craze no hard to form, na the
trekking be
wahala.
36. Its a small world!! No mean
say you fit trek from
Naija go London.
37. No matter how hot your
temper be, e no fit boil
beans.
38. Chicken wey run from Borno
go Ibadan go still
end up inside pot of soup.
39. Today’s newspaper na
tomorrow Suya wrap.
40. Akara and moin moin get the
same parent, na
wetin dem pass through make
dem different.
MY PIPUL NA LIE I TALK?
9 Sep 2015 | 12:32
0 Likes
 
 
Funny funny funny
9 Sep 2015 | 13:01
0 Likes
Abeg yu really try ooo Na confirm truth ooo
9 Sep 2015 | 13:02
0 Likes
No b lie oooo
9 Sep 2015 | 13:17
0 Likes
Lolzz no b lie o......person wey read am no smile shit get pity pass am
9 Sep 2015 | 15:39
0 Likes
3much funny...
9 Sep 2015 | 16:36
0 Likes
Lolz.... Na tru jarè
9 Sep 2015 | 17:00
0 Likes
Eleyii gidi gan. . . Dis is the comfam
9 Sep 2015 | 17:53
0 Likes
Lolzzz
9 Sep 2015 | 18:43
0 Likes
No b lie @all u b real 9ja pikin
9 Sep 2015 | 18:46
0 Likes
Comfirm true talk ooooooo lolzzzzzzzz
9 Sep 2015 | 19:04
0 Likes
Na true
10 Sep 2015 | 04:14
0 Likes
Thumbs up bro.
10 Sep 2015 | 06:30
0 Likes
lolz...nah true jare...
10 Sep 2015 | 07:02
0 Likes
Chai!! Who be dis writer mama??
10 Sep 2015 | 10:25
0 Likes
Pexin wen na.ked nr fit chuk hand 4 pocket...
10 Sep 2015 | 12:15
0 Likes
@konphido Ur head dey der
10 Sep 2015 | 16:04
0 Likes
Standard truth
10 Sep 2015 | 17:22
0 Likes
Truly Pidgin proverb
10 Sep 2015 | 19:06
0 Likes
Lie keh, mah hear nah.. Mehnnn ur yarns mk plenty brains no b small o.. Nyc 1 jare
11 Sep 2015 | 01:05
0 Likes

Report

Please describe about the report short and clearly.

(234) 9121762581
[email protected]

GDPR

When you visit any of our websites, it may store or retrieve information on your browser, mostly in the form of cookies. This information might be about you, your preferences or your device and is mostly used to make the site work as you expect it to. The information does not usually directly identify you, but it can give you a more personalized web experience. Because we respect your right to privacy, you can choose not to allow some types of cookies. Click on the different category headings to find out more and manage your preferences. Please note, that blocking some types of cookies may impact your experience of the site and the services we are able to offer.