EPISODE 4
.
.
.
Every where just went silent at once , even a pin drop could be heard. It just look as if a ghosticue been spotted. Provost stanley just stood where he was and was looking at us with a blood shot eyes, mhen if to say looking dey kill eh, all of us for drop down dead instantly cause the kind eye the able provost give us that night nearly make me urinate for my pant *omo thank God say i control the urine o if not i for become a celebrity o, infact throughout that year na me for become the fastest growing celebrity with lots of fans* i just manage to control my fears.
"i ask again na who ona dey call mad man?!!"
his voice booming this time around shaking us very well from the spirit world back to the physical world. *cause our spirits been done go on forced vacation* still nobody wan talk. Just then i come notice say every body eyes dey on me. Just then e come dawn on me say i be their oga and na me suppose to save them * chai fear no good o, see as fear make me fall my boys hands na*. Nai i just waka go near provost stanley come whisper
"oga mi , nobi wetin you dey think o, na joke my boys been dey joke suddenly one person come decide to pull stunt nai one of them come ask , na who be that mad man wey get mind to punish my oga, so we been dey get fun na, nothing more than that "
"hmmmm, you sure?" provost stanley come ask me amid doubt
"yes hundred percent sure *chai Lucky you been the greatest liar of the century*
"hmmmm?"
"yes na true, i fit even show you the guy wey talk am self." just then i come realise say something *chai lucky you don fuck up, something wey you don nearly get this guy now you don put your self inside more hot soup, you mumu o*
"okay show me the guy"
*chai see fuck up na* "you mean the guy?"
*angrily* "no, i mean the babe!"
me thinking fast as a sharp guy, i need to act fast before yawa ghast *mhenna who i fit point out now, if i point david e go fall hands and most other people them no dey fast to cover ass, wetin man go do now na? Just then solo come cross my mind.* yes solo na good guy, e dey very sharp o , and e fit play along well.
"mr man you no fit talk again?" stanley come fire back e jamb question"
"see the guy wey talk am there" pointing at solo
"oya come out" provost stanley beckon solo
solo come waka come front where we dey. On recognising him fully provost stanley shouted
"chai so after all these hours i still catch you, so na you get mind call me fry pan yansh for drill field this morning say i fit shit eggs ,so after to talk am finish you come run abi? No worry today na today make you prepare to shit those eggs you say i fit shit, cause you self get fry pan yansh and you must help me shit those eggs"
.
.
.
Tbc
AM VERY SORRY FOR NOT UPDATING REGULARLY LIKE BEFORE, YOU MUST KNOW I'VE BEEN VERY BUSY WITH WORK, EXAMS, BARRACKS CALL, EDITION WORK, POSTING OF OTHER STORIES AND ALSO WORKING ON OUR NEW FACEBOOK PAGE. ONCE AGAIN I APOLOGIES AM SORRY FANS . AND PLEASE ALSO NOTE THAT DTLC FORUM WILL SOON BE OPEN ON COOLVAL.