E get one particular ʀɛstaʊʀaռt wey i dey go
chop 4 Lekki, Lagos. E get one Oyinbo wey
dey always come chop there too...
Anytime dis oyinbo chop finish, he go shout
''Hey'', so I wonder wetin dey make am
shout. I decided to chop wetin d oyinbo dey
always chop so maybe me self go shout too.
When I reach d restaurant yesterday
evening, I order wetin d man dey chop.
Dem tell me say na chicken & red wine, so i
chop am finish, i no shout.
I collect extra plate, but i no still shout. I say
dis Oyinbo na mumu o, wetin dey make am
shout like dat? Na so i just vex ask 4 my bill.
The waiter tell me say one քʟatɛ of chicken
& red wine na N75,000 then d extra plate
too na another N75,000. Na then I shout
hey! heyy!! heyyy!!! heyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy...........Up till
now, I still dey shout .... ooo..
God bless us all.
Wish one love and Peace can still come in Coolval