My people I no know wether na poor man sense dey worry me oo, me and my guy go visist my friend for house, na so we talk as him con talk say na beans dey ground oo, we buy bread with better cold pure water, so we fit use am flex the beans. Me, my guy and my friend dey chew the food dey go as we take jam meat for inside the beans, na so we two pause look each other, fear be catch me ooo, the thing strange to use meat take cook beans. I no know wether na becos my people for house no dey use meat take chop beans or na say my sense never update to dey chop beans wey carry meat....abeg yarn us yur experience for own awkward food********